DSS present fresh evidence against Nnamdi Kanu afta Court strike out video and written statement dem bin obtain from Ipob leader

Ipob leader Nnamdi Kanu inside court
Read am in 5 mins

Justice James Omotosho of di Federal High Court Abuja don comot two video evidence and three written statements wey di Nigeria goment bin wan tender as evidence for di trial of Nnamdi Kanu.

Kanu, di leader of Ipob, a secession group for Nigeria bin tell di court say im bin dey under duress wen e write di statements, and im lawyer bin no dey present.

For di last hearing, Justice Omotosho bin order a trial within trial to establish weda or not to admit di evidences.

Delivering im ruling for di proceeding on Thursday, Omotosho say di law provide say any accused pesin suppose get legal representation bifor e go make im statement.

Omotosho first tok say di video show say di atmosphere bin dey cordial wen Kanu bin dey make di statement, and e no see any sign of coercion or force.

"However, dis court no go close im eyes to di fact say di defendant bin complain regularly about di absence of im counsel," Omotosho tok.

According to di trial judge, section 15 of di Administration of Criminal Justice Act (ACJA) provide say di statement of a suspect must to be obtained for di presence of im counsel, and wia di suspect no get counsel, an officer of di legal aid council of Nigeria or a member of di civil society suppose dey present.

Omotosho say: "Even though di statement bin dey recorded on video, di fact say di lawyer of di defendant no dey present don make di statement inadmissible in evidence

"Dis court dey empowered to also expunge di video recordings wey e bin don admit in evidence. As e don dey established say di statement no dey admissible, it holds to law say di video recordings also no dey admissible."

"I hereby order as follows:

  • Dat di statement of di defendant dated 21 to 24 October and November 4 2015 dey inadmissible in evidence
  • Dat di video recordings of di statement wey I bin don admit and marked PWQ and PWR, also dey inadmissible and hereby marked rejected.

'Wetin dey happun for Somalia go be child's play' - Nnamdi Kanu tok for video wey court play

Nnamdi Kanu in court

Afta ruling on di trial within trial, di hearing kontinu wit di third prosecution witness Mr CCC, a DSS officer wey bin follow investigate Kanu.

Di witness tell di court about one interview wey Kanu bin do wit Sahara reporters for 2014 wia di defendant bin make some serious threats against Nigeria.

Counsel to di federal goment Suraj Saida, show di court one CD plate wey e tok say na di Sahara Reporters interview wit Kanu.

Di judge admit di CD in evidence and dem play am.

For di video, di interviewer dey ask Kanu about di National Conference wey wan start, and weda e dey satisfied wit di Igbo delegation for di conference.

Kanu say e no expect anytin from di conference, but e warn di Igbo leaders say if dem no tok well for dia, make dem no return to di southeast.

E say: "If dem underestimate us, wetin dey happen for Somalia go be child's play to wetin go happen hia."

Kanu also tok say e go follow both peaceful and violent means to get Biafra. "If dem give us Biafra in peace, wonderful. If dem want war, I go assure you say dia no go be any living thing for di zoo wey dem dey call kontri," e tok.

Also for di video, Kanu mention di name of Ike Nwachukwu wey be retired army general, Rochas Okorocha wey be di govnor of Imo state dat time and also Peter Obi, and e tok say na Hausa Fulani pipo dey install govnors for di southeast region make dem dey do dia bidding.

Afta di video play, di prosecution end dia examination in chief of di witness.

During cross examination, Nnamdi Kanu lawyer Paul Erokoro ask di witness weda Kanu and im supporters kill Ike Nwachukwu or Rochas Okorocha or Peter Obi, afta dem come bak from di National Conference. Di witness say to di best of im knowledge, nobody kill anybody.

Erokoro also ask di witness weda e remember say president Muhammadu Buhari bin threaten say if dem rig di election of 2015, "di dog and di baboon go dey soaked in blood". Mr CCC say e get idea of wen Buhari tok sometin like dat.

Di cross-examination end for hia and di witness, Mr CCC comot for dock.

Justice Omotosho den adjourn di case to June 13, 16, 18 and 19, 2025 for continuation.

Court ban Nnamdi Kanu sister in-law from trial

Nnamdi Kanu and his sister in-law Favour Kanu
Wetin we call dis foto, Favour Kanu na di wife of Nnamdi Kanu younger brother, Emmanuel.

Also for di hearing dis Thursday, Justice Omotosho ban Princess Favour Kanu wey bi Nnamdi Kanu sister in-law from coming to di trial again.

Di trial judge accuse Mrs Kanu say she bin dey stream di proceedings of di court live, by posting wetin dey happen for court word for word at di exact time wey di court still dey sit, and even asking pipo to comment on proceedings wey still dey happen for live court.

For two previous occasions, Justice Omotosho bin don warn Mrs Kanu for contempt of court, and ban her from attending three court sittings.

Dis time around, di judge order her out of di courtroom, ban her from ever attending di trial again, and even ban her from entering di court premises unless she get personal matter for court.

"Henceforth, I go start to dey send pipo to Kuje prison for contempt in di face of di court," Omotosho warn.