I make two ogbonge reforms wey no make our kontri collapse - Tinubu

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X
President Bola Tinubu tok say di first two policies wey im administration take wen e enta into office na im save di kontri further collapse.
For one broadcast to mark di second anniversary of im administration on May 29, di Nigerian leader tok say di economic and general situation of di kontri wey im inherit bin require make dem redirect di kontri affairs wit a bold and new vision, and dat na why im implement "di two necessary policies make di kontri for no further fall."
Wen dem inaugurate President Tinubu on 29 May two years ago, di first two reforms wey e introduce na di removal of fuel subsidy and floating of di naira.
Dis two reforms bin get serious impact on kontri pipo as di prices of goods and service bin dey on record high and inflation rise, Nigerians bin experience di worst cost of living crisis in a generation.
"E bin dey clear say if di federal goment plus di oda two tiers of goment wan remain viable and cater to di citizens welfare, dem must do away wit years of fuel subsidies and di corruption-ridden multiple foreign exchange windows. Di two no longer dey sustainable and don become needle for our kontri neck, wey dey choke us and strangle our nation future," President Tinubu tok.
However, di president say despite di bump for di cost of living, dem don make "undeniable progress" as di reforms dey work and di economy don stable.
"Inflation don begin go down, as di price of rice plus oda food stuff don dey reduce. Di oil and gas sector dey recover; rig counts don go up by ova 400% in 2025 compared to 2021, and dem don commit ova $8 billion in new investments. We don stabilize our economy and we dey better positioned now for growth and very prepared to withstand global shocks."
Tinubu list achievements in two years
For di statement, Oga Tinubu bin highlight im administration achievements in di last two years and how im Renewed Hope Agenda don impact Nigerians.
Under di Renewed Hope Agenda, di administration bin promise to tackle economic instability, improve security nationwide, reduce corruption, reform governance, and lift citizens out of poverty.
President Tinubu say for di first quarter of 2025, dem record ova N6 trillion in revenue. Dis money na from di sales of crude oil, improved revenue generation plus greater transparency in government finances.
On di gbese wey di kontri dey owe, Tinubu say dem don pay off di IMF obligations, and di kontri net external reserves grow by almost 500% from $4 billion in 2023 to over $23 billion by the end of 2024.
E add say state revenue increase by ova N6 trillion for 2024, and dis one make subnational goments fit reduce dia debt burden, pay salaries and pension on a timely basis, plus invest more in critical infrastructure and human capital development.
One of di administration policy na to reform tax, President Tinubu claim say by di end of 2024, tax-to-GDP ratio rise from 10% to over 13.5%.
Dis na as e announce say im administration go establish Tax Ombudsman, one independent institution wey go protect vulnerable taxpayers plus ensure say di system work for everybody, especially small businesses.
On di issue of security, Tinubu say im administration don try well-well as dem record ogbonge successes for dis area.
E say farmers don dey return to farm to work. Highways wey bin dey dangerous for travellers don dey safer now and security agencies don rescue plenty abducted citizens from di hands of dia tormentors.
"Despite di new security challenges, we fit report some successes. For some areas of di northwest, wey bin dey under di control of bandits, our gallant armed forces don restore order, dem don reduce and eliminate threats to lives and livelihoods. Wit di success achieved, farmers don go back to farm to feed us."
Nigerians react to Tinubu two years in office
As Tinubu give imsef pass mark for di ogbonge tins e don achieve in two years as Nigeria leader, one opposition leader and former vice president of di kontri tok say di current administration no try at all.
Atiku Abubakar for statement tok say in just two years, "President Bola Ahmed Tinubu administration don prove to be one of di most incompetent, disconnected, and anti-people governments in Nigeria democratic history."
E allege say di policies of dis administration dey targeted at di poor.
"From healthcare to education to identity management and basic public services, Nigerians now dey faced wit class-based systems wia di wealthy dey enjoy VIP treatment, and di rest dey left behind.
Di former vice president also condemn di administration borrowing, e say e don go up to N144 trillion from di N49 trillion e be for 2023. Wit more foreign loans now being requested, e fit push di debt to N183 trillion, Atiku add.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post










