Rumour dey go round again about who go be di next James Bond

Idris Elba and Aaron Taylor-Johnson

Wia dis foto come from, Getty Images

Tori ova which actor go take on di role of James Bond don dey go round again, afta report say British actor Aaron Taylor-Johnson don gbab offer for di role.

One tori pipo The Sun don tok say di Kick-Ass and Marvel films actor don "formally get offer for di job" as di 007 spy, wey Daniel Craig bin dey play bifor.

Craig bin comot for di role for 2021 afta e bin star for five films ova 16 years.

Di next Bond film go be di 26th, afta No Time to Die.

Di BBC don tok to Taylor-Johnson and Eon Productions for comment.

Taylor-Johnson recently tell Numero magazine say e find am "charming and wonderful say pipo see me for dat role", wen e ask about di rumours wey name am as di next Bond.

"I take am as one great compliment," e bin add.

Taylor-Johnson, 33, wey bin star as John Lennon inside di biopic Nowhere Boy for 2009, now be favourite wit di bookmakers to play di role.

E bin also star for di thriller Nocturnal Animals, wey e win one Golden Globe for in 2017, Anna Karenina, Godzilla and Tenet.

Aaron Taylor-Johnson

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Aaron Taylor-Johnson currently be favourite wit di bookies to play di 007 agent
Daniel Craig

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Dem bin announce Daniel Craig as di sixth Bond for 2005 and e stay for di role until No Time to Die release for 2021

Who else dey di running to play 007?

For di past three years e no get shortage of names wey dem dey throw for di mix for who go follow Craig, wey many dey see as one tough act to follow.

Mark O'Connell, author of Catching Bullets: Memoirs of one Bond Fan, bin tell BBC afta Craig comot: "One new Bond no be just one red-carpet suit and one timepiece endorsement arm.

"E need be one movie star, one ambassador for di series and cinema, one media diplomat, one anointed son of British culture and di face of one billion-dollar ecosystem of products and endorsements.

"E need dey instantly recognisable across all di corners of di globe as James Bond.

"E need dey good looking, able to hold di camera and dominate cinema screens di size of football pitches."

Henry Cavill for Batman v Superman: Dawn of Justice European Premiere for Leicester Square, London, England for March 22, 2016

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Cavill bin play Superman for films including Man Of Steel and Batman Vs Superman

'Veri, veri exciting'

One of di current favourites to take on di role na Super Man and Mission: Impossible actor Henry Cavill wey pipo bin tink say dey di running to play Bond bifor dem use Craig.

E bin tell GQ for 2020 say e "go love to play Bond, e go dey veri, veri exciting".

One of di youngest names wey pipo tink say dey contention na 32-year-old Damson Idris.

E dey popular for im role inside US TV crime drama Snowfall wey bin run for six seasons between 2017 and 2023. E bin also play di lead role inside Netflix sci-fi action film Outside the Wire.

Damson Idris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Damson Idris bin star for TV crime drama Snowfall

Anoda favourite wit di bookies na James Norton, wey bin star recently for di stage production of A Little Life and bin dey di cast of 2019 film Little Women.

Di 38-year-old actor bin star for some of gritty TV dramas including McMafia and Happy Valley.

For 2018 e bin dimiss rumour say e go be di next Bond, and tell Evening Standard: "One ogbonge amount of rumour dey. But say as much as e be - rumour. Veri flattering, very humbling rumour."

But of course one lot fit change insde six years.

James Norton for War & Peace
Wetin we call dis foto, James Norton bin play Prince Andrei Bolkonsky inside BBC 2016 series War and Peace

Di likes of Tom Hardy, Idris Elba and Chris Evans be oda names wey don dey mentioned.

But Elba, 51, bin confam sey e fit now dey "too old" to take on di role, sake of if e stay on for as long as Daniel Craig do, e go den be 66.

Idris Elba

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Idris Elba be di favourite to take on di role for number of years afta im ogbonge popular performance as Stringer Bell inside The Wire

Producers no necessarily dey choose di biggest name for di role, afta all, Daniel Craig name bin no dey di forefront for di year afta Pierce Brosnan final Bond film for 2002.

Make we tok of Brosnan, e recently tell BBC say im fellow Irishman and Oscar winner Cillian Murphy go make "magnificent" 007.

Brosnan bifor don also previously say Bridgerton heartthrob Regé-Jean Page go make "wonderful" Bond.