Edo State govnorship election: 'I dey disappointed' - Asue Ighodalo

Read am in 2 mins

Di govnorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Asuerinme Ighodalo no happy at all sake of how di 2024 Edo State govnorship election waka.

For interview di politician and business man wey bin dey hope to takeover from Govnor Godwin Obaseki tok say im dey disappointed.

"I dey disappointed sake of say I bin tink say we go get a good transparent and effective conduct of elections,"e tell BBC News Pidgin.

E add say "as day one, I see how tins dey unfold, e con dey clear to me say dem no go do di election to dey free and fair."

"So I dey very disappointed, e con dey be like say we dey get di worst election for di history of our kontri wey happun for Edo state."

"I tink say dis fit be di worst election wey dem dey conduct in di history of Nigeria."

Im give example say one of dos places na Ologo, Ikpoba Okha - "Di total number of accredited voters for dat place for Saturday election na 156 (One Hundred and Fifty-six) di results wey dem declare give APC 2,110 and PDP 57.

Im allege say dis kain of mago-mago happun for like 50 polling units wia pipo wey do accreditation to vote no reach di number of results wey dem announce and e no dey possible.

E add say if Inec no change wit dis collabo wey dem dey do "we no go accept injustice, we be peace loving pipo for di PDP, me and my running mate we be gentle men, like say dem do di election peacefully, free and fair, we ready to take di outcome of di election."

Im explain say di Govnor Godwin Obaseki go Inec office to do tok-tok wit di Resident Electoral Commission (REC) to ask am why dem stop di collation of di votes and di REC no tok or do anytin instead im meet wit di DIG police and afta dem finish im waka comot.

"Na sake of di intervention of him (Godwin Obaseki) wey make Inec tok say dem go resume collation by 10 a.m for morning."

Im allege say APC don take over all di institutions wey dey govern di electoral process.