Accredited civil
society of organizations wey dey observe di 2024 govnorship elections don call
on di Independent National Electoral Commission (Inec) to invoke dia powers
under Section 65 of di Electoral Act 2022 to review any declarations and returns
wia results no dey declared voluntarily or wia di provisions of di electoral
act and Inec regulations dey violated.
Di civil organizations
under di aegis of di Nigerian Civil Society Situation Room, Yiaga Africa,
Kimpact Development Initiative, Nigerian Woment Trust Fund, ElectHer and TAF
Africa make dis call afta dem express on top di transparency of di ongoing results
collation by Inec.
Di election observer groups wey tok dis one for inside statement dem issue on Sunday, one day afta di Edo
state gubernatorial election say dem dey worry about di credibility of di
electoral process.
“Reports of disruption
for ward and local goment collation centres, plus intimidation of Inec officials
and attempts to collate results contrary to di provisions of di electoral act
and Inec guidelines, don raise significant concerns about di credibility of di
results collation process.”