Inec declare APC Hope Uzodinma winner, re-elected Imo govnor

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare Govnor Hope Uzodimma of di All Progressives Congress (APC) winner of di 11 November, 2023 govnorship election for Imo state.
Di Vice Chancellor of di Federal University, Oye Ekiti, Prof Abayomi Fashina, wey be di state Returning Officer declare Uzodimma re-elected on Sunday morning at about 10:am afta ova eight hours of collation of local goment results.
“Say you Hope Uzodimma of APC having satisfied di law is hereby returned elected,” Fashina declare.
Di Supreme Court for January 2020 bin first declare Hope Uzodinma as Imo state govnor afta dem cancel di election of Emeka Ihedioha of di Peoples Democratic Party (PDP), one situation wey make am attract more political enemies for di state wey dey suffer from security issues of “unknown gunmen”, kidnapping and endless Monday sit-at-home wey Ipob dey order.
Uzodimma, 64, bin seek re-election for Saturday poll and e clear all di 27 local goment areas for di state.
Uzodimma beat PDP Samuel Anyanwu, Labour Party (LP)’s Nneji Achonu, Jack Ogunewe of di Action Alliance (AA), plus 14 oda opponents.
Di APC candidate gada 540, 308 votes to defeat im closest rivals, PDP Anyanwu, wey get 71,503 votes and LP Achonu wey get 64,081.

Wia dis foto come from, Hope Uzodinma/ Samuel Anyanwu / Athan Nneji Achonu/ Facebook
Di State collation centre bin open around 02:30am for early mor-mor of Sunday for Owerri, di state capital.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na di Vice Chancellor of di Federal University, Oye Ekiti, Prof Abayomi Fashina be di state Returning Officer of di Independent National Electoral Commission (Inec) for di election.
Imo state pipo for Nigeria on Saturday vote who go lead dem for di next four years.
Na seventeen political parties participate for di election.
For govnorship election, di candidate wit di highest number of cast votes na im dem dey declare winner – na di Returning officer of Inec dey make di declaration.
According to di Electoral Act, di candidate must also get more dan one-quarter of di votes cast in at least two-third of each local goment area of di state.














