Authorities find student stabbed to death inside apartment for Texas days before her graduation

Odunsi wear white doctors coat and dey smile

Wia dis foto come from, GoFundMe

    • Author, Max Matza
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

Authorities don find one British nursing student of Nigerian heritage wey dey study for US stabbed to death inside one apartment for Houston, Texas, just days before she bin suppose to graduate, police and her family tok.

Officers find Elizabeth Tamilore Odunsi, 23, on 26 April wen dem bin go her flat to check on her, Houston police tok.

Police say she get multiple stab wounds. Dem also find one man for anoda room with at least one stab wound and dem take am go hospital in a critical condition.

Ms Odunsi bin get TikTok account, Tamidollars, wia she dey post to her 30,000 followers about her experiences as a Briton wey dey live for US.

For her last post, from 21 April, she describe how she dey ready to graduate in two weeks, and say she don already book holiday.

One online fundraiser to send her remains back toUK for burial don gada more dan £44,000 ($58,000).

"Tami be beautiful soul, full of light, ambition, and kindness," her sister, Georgina Odunsi, write for GoFundMe.

"She move from UK go United States to pursue her dream of becoming a nurse, dedicating herself to a life of care and service," she continue.

"Tragically, Tami bin dey brutally murdered just days before she bin set to graduate from university - na unimaginable loss at a moment wey suppose mark di beginning of a bright and promising future," her sister write.

According to Houston Police Department statement, officers bin dey called to di student housing complex at 15:50 local time last Saturday.

Officers knock on di door, but no answer. Dem see blood for di back concrete patio and enter di apartment.

"Di female victim bin dey discovered on di kitchen floor with multiple stab wounds. One male bin dey discovered inside di bedroom with at least one stab wound," detectives write.

Ms Odunsi bin dey pronounced dead at di scene.

Texas Woman's University, wia she bin dey study, no immediately respond to a request for comment from BBC News.

Inside one post last year, Ms Odunsi describe how she prefer living in di US to di UK, telling her TikTok followers say "di vibes dey just so much better here".

Inside a more recent post, she share video of di cap and gown she plan to wear to graduation, with di caption "3 more weeks".

Inside one earlier post, she share video of herself studying with di caption: "She no know am yet, but a year from now, all her hard work go pay off, she go dey wor as a nurse for her dream speciality."

Ms Odunsi add say she hope to get a "stronger relationship with Christ, living a quiet and peaceful life".