Nigerian Law School get first female DG for im over 60 years history

Dr. Olugbemisola Odusote wear black cloth wit cream colour beaded earrings and necklace. She wear eye glass and pack her black long braid for back.
She smile to di camera wit her maroon red lipstick.

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Dr. Olugbemisola Odusote
Read am in 3 mins

Nigeria Law School don get dia first female Director- General since dem establish am for 1962.

President Bola Tinubu approve di appointment of Dr Olugbemisola Titilayo Odusote as di director-general of di Nigerian Law School.

Im tok say di appointment go take immediate effect from January 10, 2026 and e go run on a four-year term.

For statement wey di presidency release, wey Bayo Onanuga Special Adviser to di President on Information and Strategy sign on Tuesday January 6, e say Dr. Olugbemisola go takeover from Professor Isa Hayatu Chiroma.

Professor Isa Hayatu Chiroma, tenure go expire on January 9, 2026, afta eight years of service.

As Director-General, she go dey responsible for di overall academic leadership, administrative management, and strategic direction across all campuses of di institution.

She go also serve as di primary liaison between di school, di Council of Legal Education, di Body of Benchers, and di Nigerian Bar Association.

Dr. Olugbemisola Odusote profile

According to di presidency, Dr Odusote dey 57 years and she currently be di Deputy Director-General and Head of di Lagos Campus.

She go become di first woman to lead di institution since dem establish am for 1962.

She get her Bachelor of Laws ( LL.B.) degree from Obafemi Awolowo University and dem call her to di Nigerian Bar for 1988.

She do and acquire her Master of Laws (LL.M) from di same university.

Her specialty na for company and commercial law.

Na from University of Surrey, for di United Kingdom she get her PhD in Law.

Her research interests na Public Law and di administration of justice.

She join di Nigeria Law School for 2001 as lecturer. Since dat time, she don serve for various capacities wey include head of di academic department, director of academics, and head of campus.

Odusote don publish both local and international journals. She don also present papers for plenti legal education conference.

She bin serve for committees of di Council of Legal Education and di Nigerian Bar Association.