Who dey di new board of NMDPRA wey Dangote bin get gbege wit?

Bola Tinubu, Adegbite and Magnus Abe

Wia dis foto come from, x/Bayo Onanuga/ Adegite / LinkedIN/Facebook/Magnus Abe

Read am in 3 mins

President Bola Tinubu don ask di Nigerian senate make dem do confamation for 21 nominees for di boards of both di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) and di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC).

E tok am for inside two letters wey im send give di Senate.

For di first letter, President Tinubu nominate Senator Magnus Abe to begin work as di NUPRC board chairman.

According to statement wey di Special Adviser to di President for Information and Strategy, Bayo Onanuga bring come outside on Monday, di oda nominees for di NUPRC board na Engineer Paul Yaro Jezhi and Sunday Adebayo Babalola.

Dis new appointement dey come afta Senate bin don confam Oritsemeyiwa Eyesan as CEO for NUPRC and Engineer Saidu Aliyu Mohammed as di CEO of NMDPRA.

Dis dey come afta Engineer Farouk Ahmed, Managing Director of NMDPRA and Gbenga Komolafe, wey be Chief Executive of di NUPRC resign from dia position for December 2025.

Who be di latest nominees for di oil industry

  • Senator Magnus Abe - nominated as chair of di NUPRC board. E bin represent di Rivers South East for di Senate for two terms. E also be former NNPC board member and be di current chairman of di National Agency of di Great Green Wall.
  • Engineer Paul Yaro Jezhi - na former chairman of di Trade Union Congress for Kaduna.
  • Sunday Adebayo Babalola - na former deputy director for di Department of Petroleum Resources (DPR) wey di PIA comot from 2021.
  • Muhammed Sabo Lamido - nominated to be executive commissioner for finance
  • Edu Inyang - nominated to be xecutive commissioner for Exploration and Acreage
  • Justin Ezeala - nominated for di work of executive commissioner for economic regulation and strategic planning
  • Henry Darlington Oki - wey dey nominated for di work of executive commissioner for Development and Production.
  • Indabawa Bashari Alka - dey nominated for di work of executive commissioner for corporate services and administration
  • Mahmood Tijani - dey nominated for executive commissioner for health, safety, and environment
  • Olayemi Adeboyejo - as secretary and legal advisers

For di work of di NMDPRA board, di new nominees in clude:

Adegbite Ebiowei Adeniji - dey nominated as di NMDPRA board chairman. Adeniji be lawyer wey get ova 30 years of experience of energy and natural resources isues. E bin work as special technical adviser to di Minister of State for Petroleum on upstream and gas till 2018. E also bin work for di Oil & Gas Policy team for di World Bank and now be di managing partner at ENR Advisory.

Chief Kenneth Kobani - dey nominated as non-executiove member of di board. Oga Kobani bin work as di former minister of state for President Jonathan goment and be secretary to di Rivers State goment for Nyesome Wike time.

Asabe Ahmed - dey nominated as non-executive member of di board.

Abiodun Adeniji - dey nominated for executive director of finance

Francis Ogaree - bin dey nominated for executive director of hydrocarbon

Oluwole Adama - dey nominated to be executive director of midstream and Downstream gas infrastructure

Dr Mustapha Lamorde - bin dey nominated to be di executive director of Corporate Services and Administration.

Yahaya Nasamu Yinusa - dey nominated as executive director, distribution systems

Adeyemi Murtala Aminu - dey nominated as executive director, corporate services

Modie Ogechukwu - bin dey nominated as executive director, economic regulation and strategic planning.

Barrister Olawale Dawodu - wey bin work as di Financial Reporting Manager for Exxon Nigerian subsidiaries dey nominated as di board secretary and legal adviser.