How dem find Boeing whistleblower dead for US

Boeing Aircraft

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Theo Leggett
    • Role, Business correspondent, BBC News

Dem don find one former employee of Boeing dead for America.

Di man, John Barnett, dey popular sake of how im bin dey raise concerns about di standards of production for di company.

Barnett don work for Boeing - wey be one of di biggest manufacturers of airplanes for di world - for 32 years, bifor im retire in 2017 sake of health issues.

In di days bifor im death, Barnett bin dey give evidence for one whistleblower lawsuit against di company.

Boeing tok say dem no happy to hear of Mr Barnett's death. Di Charleston County coroner confamm im death to the BBC on Monday.

E tok say di 62-year-old die from a "self-inflicted" wound on 9 March and police dey investigate.

From 2010, e work as quality manager for di North Charleston plant wia dem dey make di 787 Dreamliner, wey be a state-of-the-art aircraft dem dey use mainly for long distance waka.

For 2019, Barnett tell BBC say workers for Boeing under-pressure dey deliberately put sub-standard parts to aircraft during production.

E also tok say im uncover serious problems with oxygen systems, wey fit mean say one in four breathing masks no go work if emergency happen.

E tok say soon afta e start work for South Carolina, e bin dey concerned say di push to build new aircraft dey make dem rush di assembly process and dey compromise on safety. But di company deny di allegation.

JOHN BARNETT

Wia dis foto come from, JOHN BARNETT

Wetin we call dis foto, John Barnett na former quality control manager for Boeing

Im later tell BBC say workers bin no dey follow di procedures to track components through di factory, allowing some parts wey no good to dey miss.

E tok say for some cases, dem dey go for scrap bins carry parts wey dey substandard and fit am to planes wey dem dey build so dat dem no go delay on di production line.

E also claim say tests wey dem do for emergency oxygen systems wey dem bin wan put for di 787 aircraft show failure rate of 25%, which mean say one in four of di oxygen masks fit no deploy if real-life emergency happun.

Oga Barnett tok say im bin raise dis concerns wit managers but dem no take any action.

Boeing deny all di allegations. However, a review wey di Federal Aviation Administration (FAA) for America carry out in 2017, find out say some of wetin Barnett tok na true.

Di review find out say di location of at least 53 "non-conforming" parts for di factory dey unknown, and considered lost. Dem order Boeing to take remedial action.

For di oxygen cylinders issue, di company tok say for 2017, dem "identify some oxygen bottles receive from di supplier wey no dey deploy properly". But dem deny say dem actually put any of dem for di plane.

Afta Barnett retire, e sue di company and di legal battle don long.

E accuse Boeing of spoiling im name and frustrate im career sake of di issues e bin point out. Boeing reject di charges.

At di time wen e die, oga Barnett bin dey Charleston for legal interviews about di court case.

Last week, e give a formal deposition for court in which Boeing lawyers bin ask am questions, bifor im own lawyers cross-examine am.

E suppose undergo further questioning on Saturday, but as e no show for court, dem make enquiries for im hotel.

Na later dem find am dead inside im truck for di hotel car park.

Im lawyer describe im death as "tragic".

For statement, Boeing tok say: "We dey sad by Barnett passing, and our thoughts dey wit im family and friends."

Im death come at a time wen production standards for both Boeing and dia key supplier Spirit Aerosystems dey under serious torchlight.

Dis dey come afta one incident for early January wen an emergency exit door blow comot for one brand-new Boeing 737 Max shortly afta e take-off from Portland International Airport.

A preliminary report from di US National Transportation Safety Board suggest say four key bolts wey suppose hold di door no dey.

Last week, di FAA said a six-week audit of Boeing discover "multiple instances wia di company allegedly fail to comply wit manufacturing quality control requirements".