Boeing 737 Max 8: Aviation authority say no Nigerian Airline dey use aircraft wey crash

Air Peace plane

Wia dis foto come from, Air Peace

    • Author, Harry Itie
    • Role, BBC Pidgin, Lagos
  • Read am in 2 mins

Nigeria Civil Aviation Authority say no airline operator for di kontri dey use di Boeing 737 Max 8 aircraft.

Sam Adurogboye wey be tok tok pesin for Nigerian Civil Aviation Authority tell BBC Pidgin say as of di moment, di plane no dey Nigeria.

Im say: "fit no fit take action on top wetin neva come di kontri and na even afta operators order planes na im di manufacturers dey make am," im tok.

Ethiopian Airlines bin crash on Sunday, wey kill 157 pipo and investigators confam say di plane type na di Boeing 737 Max 8.

Dis same aircraft bin also crash for October 2018 for di hand of Indonesia Air.

Boeing

Since Sunday, some kontris like China, Ethiopia and Singapore don say make operators wey get dat kain aircraft pause first, make dem torchlight am wella.

Oga Adurogboye say for Nigeria, dem go continue to dey follow di mata and go take di correct action based on di investigations.

Air Peace don clear air ontop di Boeing 737 Max 8 dem order

Nigerian airline Air Peace don admit say dem order di Boeing 737 Max 8 aircraft, but say di manufacturers neva deliver am to dem as e still dey design.

Air Peace tok tok pesin Chris Iwarah wey sign di statement, say dem wan make pipo relax as dem dey follow di mata and wan make dia customers safe.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Some pipo for Nigeria begin shake small-small, afta Ethiopian Airlines crash and tori say Air Peace bin order for 10 of di same planes last year.

Air Peace confam say true-true dem order di aircraft o, but dem also add say dem trust Boeing and aviation authorities to address di issues afta dem finish wit di investigations on top di plane.