Agis lift phone ban on FCT land staff, approve only 'torchlight phones' afta Wike video wit Naval officer

Read am in 4 mins

Di Abuja Geographic Information Systems [Agis] di office wey dey in charge of land administration for Abuja, di Nigeria capital don make u-turn on di ban on phones for staff.

Di agency bin tell staff for memo say make dem no carry dia phones enta office premises on Wednesday 12 November, 2025 but now dem do change mouth.

For internal memo wey di agency bring out for staff, dem tok say dem dey life di ban on use of phone for di office premises temporarily.

"Sequel to di earlier directives on use of phones, I dey directed to inform all officers on Grade Level 14 and below say di ban dey temporarily suspended."

However, dem add for di memo say from 1 December, 2025, dem go ban di use of smart phones.

"Consequently wit effect from 1 December, 2025; di use of Android devices (phones, iPads etc) no go dey allowed into di office premises except 'Torch Light Phones'."

Agis say make all staff prepare demsefs ahead of 1 December wey di ban on smart phones go take effect.

According to inside sources, Agis issue di ban sake of di viral video of di kwanta wey Federal Capital Territory [FCT] Minister Nyesom Wike bin get wit one Naval Officer sake of land mata on Tuesday.

One staff wey we no go fit call di name, say Agis dey para say na one of di staff allegedly share di video wey later go viral.

Di BBC try to verify from some Agis staff if true-true di ban take effect from Wednesday as di memo tok and comfam say na true.

How di mata take reach hia?

On Tuesday FCT Minister Nyesom Wike bin kwanta wit one Navy Officer inside one video wey go viral.

Di video show how di FCT Minister bin dey para for di Naval Officer sake of say e no let am enta one land.

Di Naval Officer bin tell di FCT Minister say e no go fit enta di land sake of say e dey im duty post and all di document for di land dey available.

However, dis kwanta inside di viral video don continue to get reactions from different quarters.

One of di pipo wey don react na Mohammed Badaru, minister of defence, wey tok say di federal govment and military leadership go safeguard all sojas wey dey do dia lawful duty.

Local media report say na on Wednesday Badaru tok for Abuja for one meeting for one ministerial press briefing to mark di 2026 Armed Forces Remembrance Day.

News Agency of Nigeria [NAN] quote Badaru say "Well, for di ministry, and indeed for di armed forces, we go always protect our officers on lawful duty," Badaru tok.

"So, we dey look into dis issue, and we assure you say any officer on lawful duty go dey highly protected.

"We no go allow anytin to happun to am as long as im dey do im job, and if im dey do im job veri well."

Wetin be Agis

According to dia website, di Abuja Geographic Information Systems (Agis) na di agency wey dey in charge of land administration for Nigeria.

Na di Federal Capital Territory Act - Subsidiary Legislation No.1 of 2004 na im establish am.

Dem establish am as di centre of excellence wey go provide Spatial Data Integration and Computerization services for di entire Federal Capital Territory Administration.

Dia responsibility na to also manage di computerised operations of land administration wey include di entire production process of land titles for di FCT.

Some oda work wey dem dey do na to prepare and issuance Certificates-of-Occupancy and oda certificate titles as evidence, preparation and issue Right-of-Occupancy.

Agis dey also produce and print Title Deed Plan (TDP), dem dey name streets and number houses for di FCT too plus oda tins.