You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Video: FCT minister Wike and military officers jam over land mata for Abuja
Na serious drama wen Nigeria minister of di Federal Capital Territory (FCT, Nyesom Wike and military officials enta kwanta ova mata wey surround land issues.
Dis gbege happun wen di FCT minister wit some officials bin dey enta one land and military officers bin stop dem.
Wike, former Rivers state govnor bin vex well well as e face di soldier wey lead odas to stop am ontop di land wey dem bin wan gain access into.
Di minister kwesion di military for di approval wey dem receive to dey ontop dat land or to develop am.
As di minister dey vex dey tok, di soldier stand for im front calm and dey reply am evri kwesion wey e dey ask.
Wike ask di officers to show di document wey dem get for di land wen dem dey guide.
"Show me di document wey you get, you no get document. I be minister you no fit tell me dat. We no fit dey kontinue to get dis imounity, we no fit dey kontinue dis way."
"Wia di approval wey dem give you, how dat man for im level, even if e get problem make e write and say see wetin I get, but e go send soldiers to who intimidate who."
Meanwhile, di military officers say dem dey act on order wey one of dia ogas bin give dem.
Naso Wike vex shout ontop di soldier say nobody dey higher dan di govment and nobody go fit intimidate am.
"You no fit dey higher dan any govment, you no fit dey carry gun to intimidate pipo make dem no do dia jobs," Wike tok as e address di officers wey dey stop to enta di land.
One of di milliary officers wey dey follow Wike tok make am clear say dem get document for di land, and dem get am legally, but di minister disagree.
As di hot drama dey go on, Wike and di soldier dey throw words at each oda but while di minister dey use serious face to take cut warning give di officer, di military officer just dey calm dey stand on im words say im dey act on order.
"Dem acquire evritin legally, you go get am. I be officer wey get integrity. I no go shut up, you no fit shut me up," di military officer tok.
As di gbasgbos dey go on, naso minister Wike bin call di soldier 'fool', di soldier vex reply am say im no be fool.
"Will you stop dat, shup up your mouth, get out. I dey school, you neva see school. You be big fool. As di time wey I dey graduate, you dey primary school," Wike tell di officer.
"Oga I no be fool. I dey act on order," di officer reply Wike.
Di military officer add say, "I dey obey order. I be officer, I take to order, I be three-star general, I dey only act on orders."
Wike come tell di military officers say, "you no go develop dis property, I no go allow am, if you wan kpai evribodi, kpai evribodi. We no go allow am say becos e be Chief of Naval staff, e go begin carry land."
Wetin cause di gbasgbos between Wike and di soldiers
Afta di whole kwanta, Nyesom Wike follow tori pipo tok on wetin carry come ontop dat land.
E say di land bin dey act on dia mandate wen e hear say dem use military take chase dem comot, na why e imsef gatz stand say e wan go see tins by imsef.
"E dey unfortunate, na dis kain tin dey trouble our development. Di land department get di mandate to see wia illegal development and land grabbing dey go on."
"Wen dem come hia, dem say di military chase dem comot, I think say dem fit dey act illegally. Wen I dey office, dem call me say di military don take ova di place, I gatz come see tins for mysef."
According to oga Wike, e say dem request for di land document and also di building approval but dem no get.
Di FCT minister say e no go give chance make anybodi blackmail or intimidate am make e no do im job.
"You hear wetin di officer tok say na di former chief of naval staff send am. I no understand how somebodi wey reach dat position, go get problem, and no fit approach my office to say, 'Look, dis na wetin dey go on.'
"I no be one of dose kain of pipo wey go succumb to blackmail."