Di relocation of Gazans go be temporary, Rubio tok

Read am in 10 mins

US President Donald Trump proposal to resettle Gaza population go only dey temporary, Secretary of State Marco Rubio don tok.

Dis dey come after Trump suggestion say US go "take ova" Gaza and resettle around two million Palestinians wey dey live dia – one idea wey don cause criticism from di UN, human rights groups and Arab leaders.

White House spokeswoman Karoline Leavitt don further clarify Trump comments, say di US no dey plan to put "boots on di ground" for di territory.

Meanwhile, Israeli Defence Minister Israel Katz say Gazans "supposed dey allowed to enjoy freedom of exit and immigration", but e give few details on how e go work.

On one trip to Guatemala, Marco Rubio say Trump proposal no be "hostile" one, but a "generous move", showing "di willingness of di United States to become responsible for di reconstruction of dat area".

E say di idea na for Gazans to leave di territory for an "interim" period while dem clear di damage and reconstruction dey take place.

Under international law, attempts to forcibly transfer populations from occupied territory dey strictly prohibited.

Meanwhile, Karoline Leavitt tell journalists for White House on Wednesday say di president dey committed to rebuilding Gaza and "temporarily" relocating im residents during di process.

Trump bin tok on Tuesday say di displacement go dey permanent.

Leavitt also say di president bin no dey committed to putting "boots on di ground" in di territory but refuse to rule out di use of US troops dia.

Meanwhile, UN Secretary General Antonio Guterres tok say Gaza na big part of di future of Palestinian state, e tok am for one meeting for New York say di rights of Palestinians to live as human beings in dia own land dey comot from dia hand.

Di world, don "see a cold, systematic dehumanisation and demonisation of dis entire pipo".

Saudi Arabia tok say Palestinians no go " move" from dia land and dem no go normalise dia ties wit Israel witout di establishment of a Palestinian state.

But Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say Trump proposal fit "change history" and e dey "worth paying attention to".

ALl dis reactions sey come after Trump bin say im want im kontri to "take over" Gaza, in "long-term ownership position", and turn am into di "Riviera of the Middle East"

For one White House news conference wit Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, im say: "Di US go take over di Gaza Strip, and we go do a job wit am too. We go own am and dey responsible for dismantling all di dangerous unexploded bombs and oda weapons on site.

"Level di site and get rid of di destroyed buildings. Level am out and create economic development wey go supply unlimited numbers of jobs and housing for pipo of di area.

"We go do a real job. Do sometin different. Just no fit go back. If you go back, e go be di same way wey e bin be for 100 years."

Wen tori pipo ask am weda Palestinians go dey allowed back, im bin say "di world pipo" go live dia, come say, e go be an "international, unbelievable place", before adding "also Palestinians".

Wen dem ask am which right im get to remove 1.8 million pipo from dia home, im bin reply: "I dey see long term ownership position, and I see am dey bring great stability to dat part of di Middle East, and maybe di whole Middle East.

"Everybody wey I don speak to love di idea of United States owning dat piece of land, developing and creating thousands of jobs wit sometin wey go dey magnificent in a really magnificent area wey nobody go know."

Wen Trump bin first begin tok about demolition of Gaza days ago, calling to "clean out dat whole tin", e bin no clear how far dis tok go go..

But just before Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu visit, for im Oval Office comments before di meeting, and for di press conference imsef, e now dey clear say im dey very serious about im proposals.

Dis be like di most radical set up on already established US position on Israel and Palestine for recent history of di conflict; and dem go see am as flying in di face of international law.

In addition to how ordinary pipo wey dey ground go take see di announcement, e also fit get significant impact on di more immediate phased ceasefire and hostage release process, for dis critical point.

'Absurd': How Hamas react

Shortly afta Trump give im White House press conference, Hamas official Sami Abu Zuhri call di proposal "ridiculous" and "absurd".

"Any ideas of dis kind dey capable of burning down di region," im tok, according to tori pipo Reuters news agency.

Abu Zuhri also respond to Trump earlier suggestion say make dem resettle Gaza pipo for nearby kontris, wey im call "recipe for creating katakata and tension for di region".

"Our pipo for Gaza Strip no go allow dis plans to pass. Wetin dey required na end to di occupation and aggression against our pipo, not to expel dem from dia land," im tell multiple media outlets.

Trump comments dey come as peace tok efforts dey continue between Israel and Hamas, on di crucial second stage of di ceasefire and hostage release deal.

Jordan and Egypt reject Palestinian resettlement

Trump and im officials dey frame im call to - according to im`language - permanently "resettle" all Palestine pipo out of Gaza as humanitarian gesture, as dem claim say e no get any oda alternative for dem becos Gaza na "demolition site".

Under international law, attempt to forcibly transfer populations dey strictly forbidden, and Palestinians as well as Arab kontris go see dis as notin short of clear proposal for expulsion and di ethnic cleansing of Palestinians from dia land.

Dat na why Arab leaders don already categorically reject im ideas, wey im don dey tok more and more about over di last 10 days, wen im bin suggest say Egypt and Jordan fit "take" Palestinians from Gaza.

After Trump joint statement wit Netanyahu last night, Saudi Arabia confam im "firm and strong" position again say, im no go establish ties wit Israel without di creation of Palestine state.

For one statement on Saturday, Jordan, Egypt, Saudi Arabia, di United Arab Emirates, Qatar, di Palestinian Authority and Arab League say dat kain move fit to "threaten di region stability, risk expanding di conflict, and undermine prospects for peace and coexistence among im pipo".

For very long, e don be di desire of some pipo for Israel to expel Palestinians from dia land and to expand Jewish settlements in dia place.

And Riyad Mansour, Palestinian ambassador to UN, say Gaza pipo want to return to dia homes and rebuild "becos dis na wia dem belong and dem love to live dia".

"I tink leaders suppose respect di wishes of di Palestinian pipo," im add.

'Gaza pipo no plan to leave dis land'

One civilian wey dey live for Gaza say im dey "disgusted" over Donald Trump proposal to resettle di territory population.

Akram dey live between Rafah and Khan Younis for south of Gaza.

Im don see many of im temporary neighbours return to dia homes for north since Israel reopen crossings afta dem reach ceasefire agreement.

And although UN dey estimate say na around 70% of Gaza buildings dey damaged or destroyed since di start of di recent conflict on 7 October, Akram suggest say Palestinians go rather remain for di temporary accommodation dan relocate to anoda kontri.

"Di pipo dey strong and dem still dey willing to live and still dey willing to continue and I no tink say dem go leave dia homes," im tell BBC World Service Newsday programme.

"Pipo don dey struggle for di sake of accessing water, accessing transportation, accessing anytin wey get to do wit decent life, and they have never considered leaving this land, and I tink say dat wan dey continuous and dem no dey plan to leave dis land."

For im press conference wit Benjamin Netanyahu, Trump suggest say US taking ownership of Gaza go create stability for Middle East.

Akram reject am, as im argue sy e go "bring more destruction and fighting to di different regions, not only Gaza but also di surrounding kontris".

How di international community react

In addition, di international community don condemn Donald Trump comments on a possible US "take over" of Gaza.

Many officials dey stress di importance of a two-state solution for di region:

UK Foreign Secretary David Lammy repeat di country commitment to a two-state solution. "We must see Palestinians live and prosper in dia homelands in Gaza and di West Bank," e tell reporters on a trip to Kyiv.

Di foreign ministry in France release statement repeating dia opposition to "any forced displacement of di Palestinian population of Gaza", and say make di territory no dey controlled by a third party. E say a two-state solution na "di only one wey fit guarantee long-term peace" for Israelis and Palestinians.

For Russia, Kremlin spokesman Dmitry Peskov say a settlement for di Middle East go only possible by implementing a two-state solution, according to Reuters news agency.

Both China and Australian Prime Minister Anthony Albanese back di need for a two-state solution.

Turkey foreign minister say any plan wey leave Palestinians "out of di equation" go result in more conflict.

Trump dey see Gaza as real estate issue, former US diplomat tok

Former US ambassador to Israel say Donald Trump dey look di crisis for Gaza as "a real estate building problem".

Speaking to BBC Radio 4 Today programme, Dennis Ross say: "I really tink say im dey plan dis more as: 'We go transform area wey already poverty don hammer."

For Trump, "na real estate building problem, no be political problem", Ross tok.

"Di problem I tink for President Trump be say for dat region, im dey look am not as a political issue," im add.

Trump spend plenty years as property developer bifor im enta politics. Im Middle East envoy, Steve Witkoff, also get real estate background.

Im Middle East envoy Steve Witkoff earlier today summarise di tone around di proposal, as e about Trump, "dis guy know real estate".

And speaking before di Trump-Netanyahu meeting on Tuesday, Witkoff say e go take 10-15 years to rebuild Gaza.

Im later tell Fox News say Palestinians fit get "beta life" by leaving di territory.

Members of di legislative arm for IS tok for X say dem believe dis move by President Trump na distraction so pipo no go fit focus on wetin e wan do.

Meanwhile oda pipo believe say e no mata wetin happun concerning Gaza, wetin Trump tok go make am easier for proscribed terrorist organizations to get new members.

Since di 7 October 2023 attack on Israel, leaders wey be part of Netanyahu coalition goment, don dey demand make di war against Hamas continue indefinitely, vowing ultimately to re-establish Israeli settlements for Gaza Strip.

Dem continue dia calls and oppose di current ceasefire and hostage release deal.

Trump say e go be di "Riviera of di Middle East".

Wen dem ask am weda American troops go dey involved in di take over of Gaza, Oga Trump say, "we go do wetin dey necessary".

Im proposal amount to di most radical transformation of US position on di territory since di creation of Israel for 1948 and di war of 1967, wey see di start of Israel military occupation of land including Gaza Strip.

Gaza na already home to Palestinians wey Israel force comot from dia homes for di wars surrounding Israel creation.

Dem and dia descendants make up majority of Gaza population to dis day.

Trump proposals, if dem pass am, go mean say dat population, now more dan two million pipo, go dey forced to go anoda place for di Arab world or even beyond, to "resettle… permanently".

Dis proposals go wipe out possibility of future two-state solution for any conventional sense and Palestinians and Arab go categorically reject am as expulsion plan.

Much of Netanyahu political base and di settler movement for Israel go hail President Trump words, as dem go see am as fulfilment of a means wey Netanyahu put to stop "Gaza being threat to Israel".

For ordinary Palestinians, e mean say dem go lose dia home forever.