You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa president call Musk to calm Trump down on di land mata
South Africa President Cyril Ramaphosa don tok to Elon Musk to try to settle di quarrel wit di new US administration ova one new land law.
Oga Musk na close adviser to US President Donald Trump, on Sunday Trump threaten to cut all future funding to South Africa ova allegations say dem dey collect land and "dem dey treat certain classes of pipo very badly".
Di South Africa-born tech billionaire put mouth for di quarrel wen im ask on X why Ramaphosa get "open racist ownership laws".
Ramaphosa office say for di call to Oga Musk di president "reemphasize South Africa constitutional values wey torchlight di respect for di rule of law, justice, fairness and equality".
Last month, President Cyril Ramaphosa sign into law one bill wey go allow land seizures without compensation for certain circumstances.
Land ownership mata na long and serious issue for South Africa, most private farmland na white pipo get am, 30 years afta di end of di racist system of apartheid.
Many pipo don tell di goment to address di land reform and deal wit di past injustices of racial segregation.
For im earlier response to Trump, di South Africa president say im "goment no kolobi any land".
On Sunday, Trump write on im social media platform Truth Social: "I go cut off all future funding to South Africa until di full investigation of dis situation complete!"
Im later tok, for one briefing wit tori pipo say, South Africa "leadership dey do some terrible tins, horrible tins".
"So dat dey under investigation right now. We go decide, and until such time wen we find out wetin South Africa dey do — dem dey take land and kolobi land, and actually dem dey do things wey perhaps dey far worse dan that."
South Africa new law allow for expropriation dat one mean to seize without compensation only in circumstances wia e dey "just and equitable and e dey in di public interest" to do so.
Dis include if di property dem no dey use am and dem no get any intention to either develop am or make money from am, or when e dey pose risk to di pipo.
For more dan a century land ownership na very big issue for South Africa. For 1913, British colonial authorities bin pass law wey restrict di property rights of black pipo wey be majority for di kontri.
Di Natives Land Act bin leave vast majority of di land under di control of di white minority and set di foundation for di forced removal of black pipo to poor homelands and townships for decades until di end of apartheid three decades ago.
Anger ova these forced removals intensify di fight against white-minority rule.
For 1994, leader of di African National Congress (ANC) Nelson Mandela become di kontri first democratically elected president afta all South Africans get di right to vote.
But until di recently passed law, goment bin only fit buy land from dia current owners under di principle of "willing seller, willing buyer", wey some pipo feel say don delay di process of land reform.
For 2017, one goment report say di farmland wey dey di hands of private individuals, 72% na white-pipo get am. According to di 2022 census white pipo make up 7.3% of di population.
However, some critics dey fear say di new land law fit get disastrous consequences like e happun for Zimbabwe, wia seizures wreck di economy and scare away investors.