Tears flow freely as Iran bury late president Ebrahim Raisi wey die for helicopter crash

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, David Gritten
- Role, BBC News
Iran dey bury dia late president Ebrahim Raisi for im home city of Mashhad, four days afta e die for one helicopter crash.
Dem dey lay di 63-year-old hard-line cleric to rest for di holy shrine of Imam Reza, one ogbonge figure for Shia Islam.
Fotos from TV bin show plenti pipo wey gada for one of di north-eastern city main streets ahead of di ceremony.
Seven oda pipo bin die for di Sunday crash during bad weather for Iran mountainous north-west.
Dem include Raisi foreign minister, Hossein Amir-Abdollahian, wey dem bury on Thursday for di Shah Abdolazim shrine for Rey, one southern suburb of di capital Tehran.

Wia dis foto come from, EPA
Ebrahim Raisi burial for di gold-domed Imam Reza Shrine - one memorial to di eighth Shia imam, wey dem see as di holiest for Iran - come afta days of ceremonies elsewhere.
On Wednesday, leaders and oda dignitaries from di kontri allies and neighbours bin attend one memorial event for Tehran.
Na Raisi former First Vice President, Mohammad Mokhber, 68, wey go serve as acting president until dem hold election for 28 June bin welcome dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Also part of dose wey dey dia na representatives of di so-called “Axis of Resistance”, one loose network of armed groups wey bin receive Iranian weapons, training and funds.
Dem include di political leader of di Iran-backed Palestinian armed group Hamas, Ismail Haniyeh, di deputy secretary-general of Lebanon Hezbollah movement, Naim Qassem, di tok-tok pesin of Yemen Houthis, Mohammed Abdulsalam, and di head of Iraq paramilitary Popular Mobilisation Forces, Faleh al-Fayad.
Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, bin also lead prayers for dose wey die.

Wia dis foto come from, Getty Images
Raisi bin dey close to di 85-year-old, wey be di ultimate authority for di Islamic Republic, and many see am as potential successor.
Senior Western officials dey noticeably absent from Wednesday ceremony, dis one show dia kontris worn-out relations wit Iran.
Tens of thousands of pipo don take part for di funeral processions for recent days, wey di goment and state media don show as demonstrations of national unity.
However, many more pipo don stay for di house, wit some wey even dey celebrate di president death despite say prosecutors dey warn say dem fit face prosecution.
Millions no like Raisi sake of say e oversee di deadly crackdown on di “Woman, Life, Freedom” protests wey burst for 2022, one year afta e enta office.
E also face calls for one international investigation into im allege role on di "death committee" wey bin order di mass killings of political prisoners for di 1980s.
Im time as president go also dey remembered for one deep economic hardship and one uncommon direct military confrontation wit Israel last month, wey bin raise fears of one regional war.
Iranian authorities tok say dem still dey investigate wetin cause di helicopter crash wia e die.
Officials don tok say di aircraft - decades-old, US-made Bell 212 - bin hit one mountainside as e bin fly to di north-western city of Tabriz for fog and heavy rain.
Raisi bin dey travel wit Amir-Abdollahian, di govnor of East Azerbaijan province, Malek Rahmati, and Tabriz Friday prayer leader, Ayatollah Mohammad Ali Al-e Hashem, and di head of di presidential security team and di helicopter three crew afta di inauguration of two dams on di border wit Azerbaijan.

Wia dis foto come from, EPA













