You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin be di work of Ambassador and why e take Tinubu long to pick list?
Di screening of nominiees for Nigerian ambassadors fit happun anytime soon.
Ahead of di screenining of di 32 nominees by the National Assembly pipo still dey tok about pipo wey dey di list.
Former presidential aide, Reno Omokri wey be one of di names wey dey pipo don already openly accept di nomination.
Anoda name wey pipo dey wonder how e enta di list na former oga Nigeria election commission, Prof Mahmud Yakubu.
Di opposition, African Democratic Congress, criticise di list say many of names no deserve to enta di list.
Dia national publicity secretary Bolaji Abdullahi sign statement wey raise alarm ova di appointment say, "e go stamp di accuse say di former election chief bin no work as neutral referee for di 2023 election."
Wetin be di process to appoint Ambassadors
E don pass two years President Bola Tinubu enta office, and dis na di first time e dey appoint diplomats wey go represent Nigeria for some parts of the di world.
Dis na part of di many kwesions wey Nigerians dey ask - say why di president take dis long to appoint ambassadors.
Tori be say di list of ambassadors come out sake of di gbas-gbos between di administration and US President Donald Trump on top di mata of alleged Christian genocide for di kontri.
Di work for Ambassador for anoda kontri na to represent dia kontri president for di oda kontri.
Some sabi pipo tok say Oga Trump for no reason Nigeria mata like if to say di kontri get ambassador for di US.
According to di Nigerian 1999 Constitution Section 171 tok say di appointment of Ambassadors dey di hand of di President to appoint but must first dey confirmed by di Senate.
Di National Museum for American Diplomacy define ambassador as "di President highest ranking representative for either specific kontri or for international organization abroad."
Ambassadors dey referred to in some circles as "leader of im own mini kontri."
Afta senate confam di nominees, di appointee go collect letter of credence from di President wey go get di kontri dem dey go, dat kontri must to collect and approve di diplomat appointment bifor e go start im work.
Di tenure of Ambassador dey normally last between 3-4 years.
Di presentation and reciept of dat letter of attestation na two important ceremonies, and according to Dr Mahdi Abubakar Abba from di Department of Political Science, for Modibbo Adama University, Yola, dem be important parts of di mata for di hisptry of diplomacy around di world.
Career and Non-career ambassadors
Acccording to Dr Abba 2023 paper on di politics of appointing political and career diplomats for Nigeria, ambassadors dey do dia duty of representing dia home kontri and ginger international relations wit some primary responsibilities wey include protecting national interests, negotiationg treaties and facilitating trades.
Dat work mean say dia skills must to include;
Interest in foreign affairs and cultures, beta communication skills, among oda tins.
Howeva di benefits of diplomats wey follow from di 1961 Vienna convention follow for dia appointment. Dem include:
- Dem no fit dey arrested by dia host kontri
- Diplomatic staff and dia families dey also enjoy immunity from local laws and taxes
- Diplomats get right to follow and pesin tok for official purposes
While normally, ambassadors dey very experienced for mata of diplomacy and international relations, di way Nigeria dey run am, no be evribodi wey dey for appointment list dey run diplomacy as dia career, na why dem dvidie am to, career and non-career ambassadors.
Di men and women wey dey serve as ambassadors fit be either "career" members of di Foreign Service or "non-career" political appointees.
Di career ambassadors dey trained for di work, dem go di school and don get plenty years of experience of working as diplomats.
Non-career ambassadors na political appointment.
Di president fit appoint pesin as non-career ambassador maybe becos of im unique talent or expertise wey e go bring come di ambassadorial post no be because e get any training as ambassador.
List of nominees for ambassador
Di initial list bin get three nominees for ambassadors go US, UK and France as non-career abassadors.
Dem be Ayodele Oke, Retired Colonel Lateef Kayode Are, and Amin Mohammed Dalhatu.
Den di second list bin get 32 namesw wey include 15 career and 17 non-career ambassador nominees.
For non-career ambassadors, dem include
- Barrister Ogbonnaya Kalu - lawyer from Abia State
- Reno Omokri - former presidential aide from Delta
- Mahmud Yakubu - former chairman for di Independent National Electoral Commission (INEC)
- Erelu Angela Adebayo - former Ekiti first lady
- Ifeanyi Ugwuanyi - former Enugu governor
- Tasiu Musa Maigari - former speaker for di Katsina House of Assembly
- Yakubu N. Gambo - former Commissioner for Plateau State and di former deputy executive secretary for di Universal Basic Education Commission (UBEC)
- Professor Nora Ladi Daduut - former senator from Plateau
- Otunba Femi Pedro - former deputy governor of Lagos State
- Chief Femi Fani-Kayode - former aviation minister from Osun State
- Barrister Nkechi Linda Ufochukwu from Anambra State
- Fatima Florence Ajimobi - former First Lady of OyoState
- Lola Akande - former Lagos Commissioner
- Grace Bent - former Adamawa Senator
- Victor Okezie Ikpeazu - former governor of Abia
- Senator Jimoh Ibrahim - businessman, lawyer and Senator from Ondo State
- Ambassador Paul Oga Adikwu - former ambassador of Nigeria to the Holy See from Benue State.
Di career ambassadors and high commissioner-designates na:
- Enebechi Monica Okwuchukwu (Abia)
- Yakubu Nyaku Danladi(Taraba)
- Miamuna Ibrahim Besto(Adamawa)
- Musa Musa Abubakar (Kebbi)
- Syndoph Paebi Endoni(Bayelsa)
- Chima Geoffrey Lioma David(Ebonyi)
- Mopelola Adeola-Ibrahim(Ogun)
- Abimbola Samuel Reuben(Ondo)
- Yvonne Ehinosen Odumah(Edo)
- Hamza Mohammed Salau(Niger)
- Ambassador Shehu Barde(Katsina)
- Ambassador Ahmed Mohammed Monguno(Borno)
- Ambassador Muhammad Saidu Dahiru(Kaduna)
- Ambassador Olatunji Ahmed Sulu Gambari(Kwara)
- Ambassador Wahab Adekola Akande(Osun)
Wit promise to release list of more names of nominees