'Nnamdi Kanu go soon regain freedom' – Abia governor tok

Alext Otti and Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, ALEX OTTI/FACEBOOK/BBC

Wetin we call dis foto, Governor Alex Otti say di president go deliver im promise for dis mata
Read am in 5 mins

Nnamdi Kanu, di controversial leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) wey dey stand trial for treason and terrorism charges, go soon regain im freedom.

Dat na according to governor of Abia State Alex Otti, wey don ginger di pipo say di kontris president dey support dis move.

Oga Alex Otti tok for one state event wey President Bola Tinubu suppose attend on Friday.

"I fit assure una say I bin dey tok to di president, wey im dey support di idea. I sure say very soon, Nnamdi Kanu go regain im freedom," Otti tok for dat event wia di minister for works don represent di president.

Pressure dey mount on governors for di South-East to chook mouth for di mata to di president make dem release Kanu sake of im dey sick.

Rights groups, some Igbo elders and odas bin dey ask di federal govment to release di 58-year-old Ipob leader as dem say im health condition dey become worse.

Di Abia State governor say di president na pesin of im own word, when im tok sometin, im dey do am, so im believe say Kanu go soon dey free.

"Me and di president be friends for many years. If di president want do sometin, im go tok you wey if im no go do, im also go tok you. So wit di promises im don make, I dey sure say im go keep dem," oga Otti explain.

As to whether dis assurance go make di pipo happy be anoda mata, but dem say dem go continue to put di pressure on top di federal govment to take action on top dis Nnamdi Kanu case.

Di minister for works wey bin represent di president for di event ask di pipo for di South-East to remain peaceful.

"I ask di pipo of di South-East to unite, make una come togeda. As your brother wey I be, I don hear wetin you wan make di president hear and di comments y di governor of Abia State," David Umahi tok.

Im explain say dem dey do evritin possible to get political solution for di Nnamdi Kanu case.

"Make I assure Senator Abaribe and Governor Otti say di South-East governors bin dey work seriously on top dis mata. Dem dey try to find political solution togeda wit our senators, House of Representatives members and ministers," im tok.

"Di federal govment wit di support of di president, dey committed to deal wit di Nnamdi Kanu issue thru peaceful means. But we for dey follow di law and see di fact say di president don put di South-East for di centre of national activities."

Federal high court premises

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON/AFPVIAGETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di court also order say make di Nigeria Medical Association (NMA) investigate Kanu health status to determine weda e dey fit to stand trial

Last hearing for di case

On 26 September, di Federal High Court, Abuja bin overrule di no-case submission filed by di leader of Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu against di terrorism charges wey di Nigeria govment sama against am.

Justice James Omotosho wey dey in charge of di trial rule say govment don establish prima facie evidence against Kanu and in di spirit of fair hearing, di defendant dey required to enta im defence.

Di court also order make di Nigeria Medical Association (NMA) investigate Kanu health status to determine weda e dey fit to stand trial and weda e dey necessary to transfer am from di detention facility of di Department of State Services (DSS) to di National Hospital.

Court say di defendant Kanu still get right to life and e gatz dey alive to face im trial.

According to di court, di NMA go set up investigative panel of between eight and 10 members wey go consider weda Kanu truly get life-threatening disease, weda di medical facility of di DSS dey inadequate to treat am, and weda e even dey fit to stand trial.

Background

Remember say Nnamdi Kanu matter bin dey bifor Justice Binta Nyako of di Federal High Court Abuja, and na she bin grant Kanu bail on health grounds in 2017, but Kanu run for im life comot for Nigeria afta soldiers bin carry out security operation for im House in Umuahia, Abia State for southeast Nigeria.

In June 2021, security pipo for Kenya arrest Kanu and carry am by force come bak to Nigeria to face trial.

Di initial charges against di ipob leader bin dey 15, but Justice Nyako bring am down to seven.

Even though di Court of Appeal later strike out all di charges and discharge Kanu, di Supreme Court reinstated di seven charges as dem tok say di Ipob leader get questions to ansa.

Im dey face treason and terrorism charges