'As I dey come, na so dem dey kill my fourth son' - She try to fight but Jihadists kill her four sons

Yameogo Aminata in blue address look at di camera

Wia dis foto come from, Noel Ebrin Brou/BBC

    • Author, Nicolas Négoce
    • Role, BBC Africa
    • Reporting from, Nioronigué
    • Author, Abayomi Adisa
    • Role, BBC Africa
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 5 mins

Warning: Readers fit see wetin fit worry dem

She siddon for dark room for one refugee camp for Ivory Coast, Yameogo Aminata, 57, dey vex for di memories of di murder of her four sons by jihadists for her home-country, Burkina Faso.

For 2022, she comot from her house wen di armed insurgents wey dey terrorise communities for central Burkina Faso for almost 15 years come strike.

Di jihadists don forcefully take ova her village wia dem seize cattle and land, and kill many residents - including her sons wey be between 25 and 32 of age.

"Dem cut di throats of four of my children," she tell di BBC, her body dey shake as emotions overwhelm her.

"Wen I come, dem dey kill my fourth son."

Aminata say she bin grab knife to fight back, but dem overpower her, dem beat her, throw her into di bush, and dem leave her wit severe injuries to her head, shoulder and throat.

She say her daughter bin separate from her during di attack, and she bin dey miss since den.

For 2023, Aminata run go Nioronigué camp for neighbouring Ivory Coast, as she keep di clothes wey get di blood of wetin happun dat day as reminder.

"I no know how to handle my life. I get nothing," she tell di BBC.

Dem don kill at least 10,000 pipo for di insurgency for Burkina Faso, wey also be neighbour to Mali and Niger.

Di United Nations don describe di region as di "epicentre" of global jihadist violence.

 Vladimir Putin meet wit President of Burkina Faso Ibrahim Traor during celebrations of di 80th anniversary of Victory for di Great Patriotic War for Moscow, Russia on May 10, 2025

Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Burkina Faso military ruler Capt Ibrahim Traoré don build strong relationship wit Russia President Vladimir Putin

Military juntas seize power for all three countries, wit promise to stop di insurgency.

Dem don move away from dia traditional allies for di West, and don turn to Russia for military aid.

Although Russian forces, dey deployed to Burkina Faso under di banner of dia Africa Corps, di insurgency don kontinue, wia di most powerful militant group na al-Qaeda affiliate, Jama'at Nusrat al-Islam wal-Muslimin (JNIM).

Like Aminata, 60-year-old farmer Hassane Tall run comot from northern Burkina Faso for 2023 wit im three wives and 19 children afta dem endure multiple attacks.

"We escape clashes between jihadist groups and security forces," e say. "We tink say we go die."

Now living in di Nioronigué camp, e say to comot from im ancestral land dey painful to am, but e see no future back home for im family.

Di 12-hectare Nioronigué camp wey dey house Aminata and Tall dey close to di Burkina Faso border. Dem establish am for 2023 by di UN and Ivorian authorities.

E dey designed for about 6,000 pipo, dis camp and di nearby Timala camp now hold around 13,000 refugees - far beyond di capacity.

UN data show say more dan three million pipo dey displaced by various conflicts for di Sahel region.

More dan 80,000 pipo from Burkina Faso now dey live for camps for Ivory Coast.

While she dey express gratitude for di shelter wey dem give her, Aminata say: "I thank di state of Ivory Coast, and all di Ivorians."

"I comot for my house becos jihadists chase us out. Dem say dem want di country," she add.

A woman has a bucket on her head, which is being filled with water

Wia dis foto come from, Noel Ebrin Brou/BBC

Wetin we call dis foto, People fleeing violence have been welcomed into Ivory Coast

Similar tori of loved ones wey don lost wit trauma dey across di camp.

Some of di refugees na from Mali. Dem include 27-year-old finance graduate.

E and im brothers recently make perilous journey for wooden boat down di River Niger from Gao for northern Mali to di capital, Bamako, den take bus to northern Ivory Coast for safety.

Di graduate say dem dey forced to leave afta dia 24-year-old cousin dey killed by suspected jihadists.

"E be fisherman. E bin dey come from fishing for night as usual. Dem attack am by two men riding motorbikes. Dis na tins wey dey happun evriday.

"We dey live in fear, not knowing if we go wake up di next day," e tell di BBC.

Ivory Coast economy na one of di region fastest growing, but unemployment and poverty dey high, wit locals for border areas dey worry about di influx of refugees.

But govment representative Djamatigui Touré tell di BBC say dem no go turn di refugees away.

"Dose wey come na our brodas; we share di same history and culture," e say.

Howeva, di UN Development Programme resident representative, Blerta Cela, warn say resources dey under severe strain.

"Di number of refugees don increase tremendously. Di majority of dem no dey for di camps. Na Ivorian families dey host dem" she say.

For Aminata, to start again for new country come wit di weight of memories from di life she leave behind.

"I still no fit erase wetin happun to me," she say.

"We just pray to God say peace come back to Burkina Faso."

Additional reporting by Noel Ebrin Brou