You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lawyers of Ipob leader decline comment ontop NMA investigation into Nnamdi Kanu health
Di Nigeria Medical Association (NMA) don carry out independent investigation to know di health status of Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob).
According to Aloy Ejimakor, one of Kanu lawyers, di NMA team bin do dis investigation on 23 September 2025, three days bifor di court hearing of 26 September, wia Justice James Omotosho give order for court say make di association do dia own investigation and advise di court on wetin to do.
Di reason for dis independent investigation na bicos Kanu lawyers bin apply for di court to transfer am from di custody of di Department of State Services (DSS) wia e dey for detention since June 2021, to di National Hospital for Abuja, sake of di life-threatening health challenges wey e get.
However, di DSS say even though dem agree say Kanu get health challenges, dia medical facility for di DSS headquarters go fit handle im mata, so no need to transfer am to National Hospital.
So di trial Judge gatz involve di NMA as a third party wey no go dey partial, to chook eye for di mata by diasef and tell di court wetin to do; weda to transfer Kanu to hospital or to leave am for di DSS custody.
Di court fix 8 October 2025 to review di report of di NMA and give ruling on top di matter.
Wen our tori pesin reach out to Ejimakor dis Monday morning to ask am about di NMA investigation, e reply say: "Yes. I dey aware of di medical evaluation of Mazi Kanu by a team from NMA on 23rd September 2025."
"And I bin don write letter to dem demanding a copy of dia report, way bifor di Court bin order dem to file di report with the Court.
"Mazi Kanu sibling, Prince Emmanuel Kanu bin dey present at di evaluation wey dem do on 23rd September 2025."
Local tori pipo, Punch, also report say di Secretary-General of the NMA, Ben Egbo, bin confirm say dem bin set up a team of seven specialists for different aspects of medicine - plus one coordinator - to do di investigation on Nnamdi Kanu.
"We get di seven doctors from di seven geopolitical zones of Nigeria wit different fields of specialty in Ophthalmology, Neurology, Urology, Gastroenterology, and oda various areas of specialty," Egbo tok.
According to di NMA oga, dem don submit di report to di office of di Attorney General of di Federation, "Anyone wey want details make dem contact di Ministry of Justice," e tok.
Ejimakor tell BBC News Pidgin tori pesin say dem neva get copy of di report so dem no fit comment anytin about am.
Di next date for Nnamdi Kanu trial na on Wednesday, 8 October.
Remember say Nigeria govment bin sama di Ipob leader wit 15 count charges of terrorism, treason and plan to scata Nigeria govment, but di court later bring di charges down to seven.
Ipob, di group wey Kanu be dia leader, dey fight for di independence of di southeast region of Nigeria to bicom a kontri of dia own wey di name go be Biafra.
Im trial don dey on since 2015 wen dem first arrest am for Lagos as e come back Nigeria. Den in 2017, afta di court grant am bail sake of im health, e run comot from di kontri wen soldiers invade im house for Umuahia, Abia State.
Security pipo rearrest Kanu for Kenya in 2021 and carry am by force come back Nigeria, even though im lawyers dey claim say na kidnap dem kidnap am and di way dem bring am back dey illegal.
Many pipo for govment for di southeast region of Nigeria don chook mouth for Nnamdi Kanu mata as dem tok say di mata no be court issue but say na political solution e require.
In May 2022, Anambra State Guvnor Chukwuma Soludo bin visit am for di DSS detention wia e dey and dem discuss. And Soludo bin beg former President Muhammadu Buhari to release Kanu to am, but dat one no work.
Only few days ago, di current guvnor of Abia State, Alex Otti, say im don raise Nnamdi Kanu mata wit again wit President Bola Tinubu and e support di idea. "I sure say very soon, Nnamdi Kanu go regain im freedom," Otti tok for one event wia di minister for works Dave Umahi bin represent di president.
"Me and di president don be friends for many years. If di president want do sometin, im go tell you, if im no go do am, im also go tell you. So wit di promises im don make, I dey sure say im go keep dem," Otti tok.