French Prime Minister Sébastien Lecornu resign less dan one month afta appointment

Read am in 3 mins

France Prime Minister Sébastien Lecornu don resign, just few hours afta im show di new cabinet.

Na di Elysée Palace make di announcement afta Lecornu meet wit President Emmanuel Macron for one hour on Monday morning.

Di resignation shock pipo sake of say na just 26 days afta dem appoint Lecornu as prime minister, afta di former govment under François Bayrou collapse.

Plenty political parties for National Assembly vex well-well about di kain pipo wey Lecornu put for im cabinet, dem tok say di cabinet no change from Bayrou own, and dem even threaten say dem go vote am down.

Plenty political parties don dey shout say make early elections happun, and some even dey call make Macron resign too - but e don always tok say e no go step down until im tenure end for 2027.

"Macron gatz choose: either make e scatter parliament or make e resign," Sébastien Chenu tok - one of di big pipo for di far-right National Rally (RN).

French politics don dey unstable since July 2024, wen dem do quick parliamentary election wey no give any party clear majority.

Dis wahala don make am hard for any prime minister to get enof support to pass laws and yearly budget.

Lecornu - wey be former armed forces minister and Macron loyalist - na di fifth prime minister wey France don get within less dan two years.

Bayrou govment chop poor vote for September afta parliament no gree support im austerity budget wey wan cut govment spending by €44 billion ($51 billion; £38 billion).

France deficit reach 5.8% of GDP for 2024 and national debt don climb to 114% of GDP.

Na di third highest public debt for eurozone afta Greece and Italy, and e mean say eviri French pesin dey owe almost €50,000.

Stock market fall well-well for Paris exchange afta tori of Lecornu resignation break on Monday morning.