Solidstar and oda Nigerian stars wey don reveal wetin drugs use dia eye see

Nigerian entertainers

Wia dis foto come from, @toyin_abraham/@tontolet/ Getty Images/ Instagram/@officialsolidstar/Instagram

Ova di weekend, Nigerian celebrity Solidstar comot with ground breaking tori on how dem introduce am into wetin dem dey call ice.

For interview wit di Honest Bunch Podcast, di music star wey im real name na Joshua Iniyezo reveal say for 2021 dem introduce am to one drug substance wey dem call ice.

E tok say, "I bin go Festac say I make I go chill for Festac, I don plan myself say na hotel I wan stay for full six months. In di process I make some new friends and some of di young young guys come introduce me to dis substance wey dem dey call ice.

"So, na dia I come begin dey take am, in fact na me dey take am pass. I dey take am morning, afternoon, night."

For di interview, e explain wetin di drugs fee like. "Di tin go dey tell me sometimes say I be king, as king I no need to pay for stuff. So if I call for food, and dem tell me say dem no go bring am till I pay, I go go fight dem."

Solidstar also reveal say di tin bin no dey let am sleep or chop but bin dey boost am to work well.

On top im healing journey e say, "di first time I go Yaba, na my broda lie gimme say I get interview for dia. I stay dia for good one month. Na dia dem tell me say, no be king you be, you be regular pesin you no need to dey take drugs".

No be for only dis interview e don open up concerning di mata wey deal wit im mental health.

For 3 March, Solidstar write for social media say, "moving forward I promise say I go use my platform take advocate for mental health awareness".

E get oda celebrities wey don open up say dem fall into di web of drugs for dia life.

Solidstar

Wia dis foto come from, Instagram/@officialsolidstar

Tonto Dike

Nigerian actress Tonto Dike reveal for interview wit BBC Pidgin say she bin get issues wit drugs.

For 2019, she reveal say, "drug no be somtin wey I don really tok about for public bifor, but na somtin wey be say set me back a lot for life.

"So, bicos say today I don be who I be and I dey clean, I wan take di 'Say No to Drugs' back to di streets through di Tonto Dike Foundation".

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Timaya

Timaya

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigerian musician Timaya reveal for one radio interview, earlier dis year say, "I no be saint, I don do drugs".

E reveal say, "No be marijuana I take. Weed no dey bad. I bin dey do drugs. And if you see me you go know, cos I tin back den wella. I bin dey gym oh but I dey also take drugs."

As to how e start, e say, "I bin neva dey into all dis, for all my life and my career, na during Covid, 2020, evribdi dey house. And I just meet some young guys, I go dia house and evribodi just happy, I just say how una dey happy pass me wey be oga and get moni? And dem tell me say dem get Molly."

E explain how di drug make am feel, e say, "Bro, wen I take am, I just happy, I dash all di moni wey dey my pocket and I just bin wan continue to dey feel like dat. Na how I take lose plenti weight o! I no dey chop, I just happy."

On how e make am feel to beat di habit, Timaya wey im real name na Inetimi Timaya Odon say, "e be hell. na tough fight".

Toyin Abraham

Toyin Abraham

Nigerian actress and producer Toyin Abraham for 2017 reveal say she bin dey take codeine as well as oda hard drugs.

For one event, she reveal say, "I bin get a lot of bad habits, but last year na di worst, I bin dey take codeine. Dem dey say codeine dey make you high, forget am, I bin dey take am well-wel. I gatz stop.

"Yes, I bin dey do drugs but I gatz stop."

As to wetin di drugs do for her bodi she say, "I bin no know say I bin dey look so horrible, bicos I bin dey veri skinny."

She tok say she make up her mind to stop. She say, "I tell my team say I wan stop, bicos I know say di first tin to greatness na to open up".

How to stop drug addiction

Pesin wey dey affected go need to do most of di work if e no wan remain addict. According to one teacher for Kaduna ministry of education and former drug addict, Andrew Dodo, "80% to 85% of di work dey im hand."

Even if family and friends wan make im leave di dangerous habit, weda pesin go recover or not from addiction dey im own hand.

So to stop addiction, addict gatz to decide say im wan beta life for imsef.

Na only im fit make dat decision and na only im fit help imsef stop di habit.

Below na wetin addict fit do to stop drug addiction:

Enta rehab

Some addict go need to get medical treatment becos, only im no got fit overcome di palava alone.

Most times dem go need to enta rehabilitation centre where doctors go fit help dem gradually stop di addiction.

According to Hadiza Aliko Mohammed wey be founder for House of Recovery, Kaduna, some pipo addiction don bad sotey if dem try to stop di drug by demsef dem go die, so na only rehab be di ansa.

Join support group

To successfully stop addiction, di addict need to dey for group wey go help am make sure say e no go back to di bad habit.

Oyibo dey call dis one peer recovery support programme.

Di idea na to make sure say pipo wey dey suffer di same tin wit you go fit share how dem dey take manage di challenge of living dia life witout dat tin wey dem dey addicted to.

No even start at all

Di most important one be say, if you neva start to touch drugs or substance, make you no even begin at all.

According to Hadiza, addiction be like hypertension and diabetes, e no get permanent cure.

For Andrew, e dey important to teach young pipo make dem understand say to be drug addict no be life at all.