You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Arsenal beat Man United to go back to di top of EPL table
Na very magical outing for Arsenal afta dem beat dia regular rival Manchester United for Old Trafford.
Na very tight game for di first 20minuntes of di match but tins turn around wen Leandro Trossard find one correct angle to put di ball behind Onana.
Trossard put Arsenal for early lead at di 20th minute afta scoring from di side of di net to make di scoreline 0-1 against di Red Devils.
Di win dey very crucial to di hope of Arsenal winning di Premier League title dis season and dem do everitin possible to keep di winning scoreline wit just one goal.
Saka and Declan Rice try to create magic so dem go fit seal di lead wit anoda goal but Onana say no.
Every shot from different angles dey stopped by Onana and im dey push some go corner too.
For di 52nd minute, Garnacho dey hungry for goal so im team no lose for dia home but di goal no come.
Casemiro also dazzle for di goalpost but im no get chance to convert di chnaces to goal for im side.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 82nd minute for be a really changing time for Arsenal to put a seal of anoda goal. Martinelli and Declan Rice try different shots at di post but Onana save am again.
Raya wey be Arsenal goalkeeper really save di Gunners wit different blocking.
Arsenal dey top di league wit 86 points while dia biggest contender Manchester City dey second position wit 85 points.
Man United on di oda hand dey eight position wit 54 points - 3 points below Chelsea.
Sadly, Raya chop yellow card for di added time, afta im try to hold di ball for long- but im no still allow any shot from Garnacho to enta net.
If Arsenal go fit win di Premier League afta a long time, go dey determined by wetin go happun for di next game.
Di game as e happun
Man United 0 vs 1 Arsenal
FULL-TIME
90mins+5- Arsenal still dey lead as Man United dey find goal. Raya dey catch every shot wey Garnacho dey play.
Yellow Card for Raya- Im dey hold di ball too much for Arsenal
90mins+3- Garnacho fire long shot from di yard of di box, but e no enta post- Goalkick for Arsenal.
Odegard out, Jorginho in for Arsenal.
90mins+2- Di game dey hot dey go as di two teams enta final added time. Raya dey try hold on to di ball.
6mins Added Time
Man United 0 vs 1 Arsenal
89mins- Martineli and Declan Rice dey pressure Onana.
88mins- Antony dey play for di left hand side for Man United. Ohhhhh, Diallo dey offside
86mins- Man United make three changes at di same time- Eriksen and Forson don enta. Di game continue
84mins- Casemiro dey try im leg on some skills.
82mins- See as dem free Martineli.. Ohhhhh, what a shot saved by Onana, Declan Rice fire long shot. Serious struggle for Man United goalpost oooo.
Gabriel Jesus enta for Arsenal
SUBSTITUTION
81mins- Be like say Saka don get small injury oooooo.
80mins- Counter attack, Garnacho move wit di ball, Ohhhhhhhhhh Raya save di shot. Di game don dey hot for dis minute oooooo. Back to back long shot from Arsenal side go Man United side.
78mins- Whaaaaaaaaaaaaaaaaaattttttttt, a brilliant shot by Martinelli but Onana push am comot. Corner for Arsenal- Saka dey take am.
76mins- See goal wey Man United lose ooooo, kaaiiiiiiiii. Dem for dey happy by now.
Kambwala enta for Man United
SUBSTITUTION
74mins- Be like say Garnacho na di weapon wey come form im sef against Arsenal ooo, see as im dey pressure Arsenal defense. Im wan penetrate through
73mins- Small time still dey for Man United coach to come up wit a solution. Arsenal dey play cool game as dem dey try push Man United comot for dia box 18.
Man United 0 vs 1 Arsenal
71mins- See small shot wey Antony play. Kaiiiiiiiiii- e for be goal for Man United oooooooo
70mins- Yellow card for Saka afta im fall Man United player wey dribble am
SUBSTITUTION for Man United ( Antony enta)
67mins- Casemiro try a long shooottttttttttt, ohhhhh, but Raya catch am.
Martinelli enta for Arsenal. We go see if im go fit change di game small
SUBSTITUTION
64mins- Havertz deflect di ball go di hand of Onana. Be like say Onana gentle small for dis match but di goal wey enta net go still dey pain am.
63mins- Dis Garnacho guy dey pressure di Arsenal defense oooo. Even Arsenal midfielders don dey fall back to prevent an equaliser.
60mins- Ohhhhhhhhh, what a close shot... Garnacho wit a long shot but na ova di bar e go. Man United dey really find goal.
Garnacho fall for inside box 18 but referee no look im side ooo.
57mins- Kaiiiiiiii. Garnacho for equalise oooo, but e go run pass di ball for Arsenal box 18 and di defender clear am.
55mins- Ohhhhhhhh, Declan Rice shot no enta net. Trossard try to regain di ball but e no reach. Chaiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiii, e for be anoda goal for Arsenal oooooo.
54mins- Raya dey really try for Arsenal. If not, dem for don chop plenti goals for Man United hand.
52mins-Garnacho dey find goal for Man United by all means, so dem go fit level di score.
Throw-in for Man United close to di middle line.
52mins- Plenti crowd for Old Trafford, from all angle but dia team neva put smile for dia faces.
50mins- Man United dey spend plenti time for di front of Arsenal net ooo
49mins- Be like Garnacho don really charge ooooo. Im dey use di eyes of Arsenal defenders dey see shege like dis oooo
46mins- Trossard dey ball ooooooooooo. Im no wan gree for United defenders.
SECOND HALF DON START
Man United 0 vs 1 Arsenal
For di first half, Man United dey lead wit ball possessions but dem neva convert am to goal.
HALF-TIME
47mins- Different shots from different angles as Man United dey try find goal
Man United 0 vs 1 Arsenal
46mins- Oh what a shoooottttt, but Arsenal goalkeeper stop am
3mins Added Time
44mins- Man united dey really put pressure for Arsenal box
42mins- Ten hag dey worried about how di first half wan end as im dey waka round di field
40mins- Man United launch long shot but e no reach to score. Saka clear a dangerous ball comot for post.
35mins- Saka trying to create some chances but dem gree for am
32mins- Great chances by Man United trying to find dia way into Arsenal net
30mins- Incredible play so far by Arsenal
27mins- Ohhh, Tomiyasu shot no enta net. Be like say Man United goalkeeper Dey kampe.
25mins- Arsenal dey put pressure on top Man United
22mins- di game is back in play
Man United 0 vs 1 Arsenal
Trossard score for Arsenal
GOOOOOAAALLLLL
20mins- Arsenal dey good position and dem dey play wit cooperation.
17mins- Partey and Saka dey try use pass enta di Man United defense. Declan Rice also dey on standby
15mins- Di fans dey cheer both teams. But Man United dey get chance for Arsenal box 18
13mins- Oh what a hot run. Corner for Man United, but e dey cleared away.
10mins- At dis point, Arsenal midfielder dey try square play for a chance to score
corner for Arsenal. Saka play di corner but Gabriel no convert am into goal, e go over di bar.
8mins- Saka wit a cross but e go corner.
6mins- Man United dey try different attempt for Arsenal post.
4mins- Arsenal dey secure dia goalpost well.
2mins- Man United dey play wit confidence on di pitch.
0mins- Match don start.
Match facts between Man United and Arsenal
Head-to-head
Manchester United defeat for dia past 16 home league games against Arsenal na 1-0 for November 2020.
Di Gunners bin win dia September 2023 fixture 3-1 sake of di of stoppage-time goals from Declan Rice and Gabriel Jesus.
Arsenal last six league away wins versus Manchester United na all by a 1-0 scoreline.
Manchester United
Manchester United don chop beating for 18 of dia 48 matches dis season. Dem neva lose 19 in a single campaign since 1977-1978 season.
But wetin go happun for dis season?
Di last time Man United finish on 13th position - outside of top seven, na 1989/1990 season wia dem lose 16 games.
Di Red Devils don concede 81 goals in all competitions.
Wetin happun against Arsenal today bin dey crucial to determine if dem go suffer a club record-equalling ninth home defeat of di season for di first time in 50 years.
Marcus Rashford dey involved in six goals for im last four Premier League starts against Arsenal wia im score four and assist two.
Arsenal
Arsenal set an outright club record on Sunday of 27 winning in a 38-match league season.
Dia only points wey dem drop for di 16 Premier League fixtures in 2024 na from di 0-0 draw for Manchester City on 31 March and a 2-0 home defeat versus Aston Villa last month.
Di Gunners dey unbeaten in eight away league games – winning seven – for di first time since wen dem win 12 unbeaten from March to December 2016 under Arsene Wenger.
Arteta side now don keep 11 clean sheets in top-flight away matches dis season.
Arsenal don score 89 league goals dis season- a record wey dem neva beat six years wen dem finish wit 90 goals.
Now, dem don win two of dia seven away league games for di current campaign against di oda teams wey currently dey di top eight.
Dem win 3-2 against Tottenham on 28 April.
Di Gunners bin don lose dia final Premier League away fixture for three of di last four seasons without scoring.