How Man City come from behind to waya Man Utd 3-1 for house

Manchester City really show Manchester United real game wit dia incredible win for di Etihad stadium.

Na Phil Foden and Erling Haaland bin use red pepper rob di eyes of Man United afta a hot 90minutes game wit added time.

Foden bin shoot one big shot for Onana wey dey Man United goalpost and naso di first goal bin happun. Di equaliser give Man City an edge to put more pressure.

For di 80th minute, Foden strike again to give Man City a great lead. Na how sand take enta Man United eyes be dat as dem struggle to find anoda goal.

Marcus Rashford really play good game for Man United but e no too convert to goals for di Red Devils. Afta im score di early goal, na dia e end as im join di forward to find goal.

Haaland wey plenti pipo don begin call 'Goal-scoring machine' break United back wit im last minute goal to give Man City dia three points clear.

Garnacho also perform well for dis game but im shots no convert to goal.

Man United coach say dem need to accept di loss like dat and dem fit do better next time.

How Manchester City 3-1 Manchester United live updates take waka

FULL-TIME

Man City really do a great comeback to win di game

Manchester City 3 vs 1 Manchester United

96mins- Dis charge wey Man United dey give no fit produce anytin again.

Man Ciry really show Man United red pepper for Etihad stadium.

94mins- Dis game dey hot ooooo

Manchester City 3 vs 1 Manchester United

Haland score third goal for Man City

Erling Haaland na goalscoring machine wey no dey miss good chance to score

91mins- GOOOOOOAAAALLLLLLL

90mins- De Bruyne give one long strike wey Onana no fit catch

Dis game get as e be oooo

87mins- Corner for Man City- from both sides.

See as dem drag Haaland shirt but referee no talk anytin shaaa

86mins- Big trouble for Man United as De Bruyne dey move wit ball very fast. Di ball go corner

83mins- Man City just dey play for Man United goalpost and di pressure plenti oooo

Tears don dey Man United fans eyes like dis oooo

Manchester City 2 vs 1 Manchester United

Dat was a great chance for Foden to score and im no miss am.

FODEN na di hero of dis match as e score anoda goal for Man City

80mins- GOOOOOAAAAAAAAALLLLLLLLLLL

78mins- Could dis be a penalty kick? Chaiiii, Man City keeper collide wit United striker but referee no give any penalty

77mins- Wetin Onana dey do wit ball outside im box. Why im dey dribble ooooo

75mins- Good posession by Man City, but Man United also dey give dem pressure

72mins- Man City dey try different shots for Man United goalpost

70mins- Ohhhhh, Onana dey save for dis match oooo becos dat shot wey im block from shirt number 2 na good one

69mins- De Bruyne no fit convert di free kick to goal as defenders block am back... Di ball still dey within Man United goalpost

Free Kick for Man City....

Manchester City 1 vs 1 Manchester United

SUBSTITUTION- Man United make changes for dia team

67mins- Haaland wan injure Man United defenders wit dribble, naso one of dem collect yellow card

66mins- Garnacho and Casemiro wan create some chances for Man City defence line but di defenders no gree

64mins- E be like say Onana don injure but medical team dey attend to am so e go fit kontinuu to dey play

62mins- Di game dey hot for dis time and both teams dey pressure well

60mins- Corner for Man City.

Pressure don dey Man United head like dis oooo

58mins- SUBSTITUTION

Doku comot for Alvarez to put di midfield for Man City

Foden bin equalise for Man City from a great strike.

Manchester City 1 vs 1 Manchester United

Foden don score for Man City. dat was agreat strike from an outside shot wey Onana no go eva fit catch

55mins- Gooooalllllllllllllllll

52mins- Garnacho dey hold ground well well for Man United

Haaland neva see chance score since ooooo but im no give up as e dey try im luck for post

Rashford dey make some great runs wit di ball, but Man City midfielders no allow am run too much

49mins- Man City still miss anoda big chance again. How, how, how. E suppose be goal but be like say luck neva dey Man City side

48mins- Man City players no still wan greee

45mins- Man United dey lead di game and e go dey surprising if dem end am like dis becos e go prevent Man City from moving higher for di League table.

Second half don start and e be like say both teams dey well charged

SECOND HALF

Bifor di second half bin start, e really show say Pep Guardiola no dey happy since Man City neva equalise

Manchester City 0 vs 1 Manchester United

FIRST HALF

First Half don end and Manchester United dey lead wit one goal.

47mins- Onana save anoda straight shot naso im sleep for ground ontop di ball

Dat long shot from Man City player just fly over di post ooo

3mins added time

45mins- Foden dey create good chances for Man City but nobody don convert am yet

44mins- Haaland no wan gree ooooo, but im miss dis great chance to score afta Foden give am correct assist. Naso Guardiola put hand for eyes say im team neva equalise

43mins- Haaland strike no enta post oooooooo. Chaaaiiiiiiiiiii

Manchester City 0 vs 1 Manchester United

39mins- Man City dey put pressure ooooo

36mins- Be like say Haaland no too happy as tins dey go, im dey find goal but nothing don show

33mins- Onana don push hot shot go corner, na small remain make di shot enta but be like say Man United dey in control for dis game.

31mins- Haaaalaaaaanddd, Oh, Haaland no land well wit di ball.

Man City dey try put pressure but nothung don show.

Manchester City 0 vs 1 Manchester United

28mins- E be like say Onana dey in-charge today oooooo. Im dey try keep di balls away from di post. Im don get some saves today.

26mins- Di ball possession dey Man City leg but na Man United dey lead wit 1 goal

24mins- Man City dey try pass through corner enta Man United goalpost but nothing don show for now.

23mins- Ohhhhhh, Rashford make some good moves for dia but e no complete am.

22mins- Foden hit hard for Man United post but Onana still guide am

20mins- Fernandes dey try create magic, but e neva go through

18mins- Man United almost enta wahala for dia box 18 oooooo but di defenders stand gidigba

17mins- Chaaiiiiiii, na small remain make Man United double dia lead but Rashford no fit control di ball well for front of Man City goalkeeper.

15mins- Man City dey really pressure Man United for dia goal post

13mins- Onana still dey in form and dey save some shots on target

9mins- Marcus Rashford put Man United for di lead. Di long shot really stretch Man City goalkeeper but im hand no touch am

Goaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaallllllll

7mins- Onana try stop one big shot.

5mins- Man United don also try enta enta di net of Man City

3mins- Man City dey press Man United for dia box 18

1min- Match don start between Man City nad Man United

0min- FIRST HALF begin