Queen Elizabeth II: In fotos- world reacts to di Queen death

Condolences don dey pour in from around di world following di death of Queen Elizabeth II.

Dem lower flags to half staff for various locations, wey include di White House and US Capitol in Washington DC.

Crowds don gather to mourn and leave flowers in di Queen memory.

Di UK longest-serving monarch die at Balmoral aged 96, following her 70-year reign.

President Joe Biden go di British embassy in Washington to sign condolences book.