David Umahi: Ebonyi state governor mata wey court sack am from office afta e defect and wetin fit happun next

Wia dis foto come from, David Umahi:
Reactions still dey follow di decision of di Federal High Court for Abuja wey sack di Ebonyi state Govnor David Umahi from office afta im defect or port go APC.
Govnor Umahi for im reaction reject di ruling and say im go appeal di mata.
"We go file appeal against dis useless judEbonyi state Govnor, Dave Umahi say im go appeal di decision gement," Govnor Umahi tok, come add say: " I still be di govnor of Ebonyi State."
On Tuesday, di Abuja High Court declare di porting of Ebonyi state govnor and im deputy govnor illegal, null and unconstitutional.
Justice Inyang Ekwo make dis judgement based on case wey PDP file to ask for di removal of govnor and im deputy from office.
Justice Ekwo give order to sack dem on di grounds say na PDP win di election on March 2019 no be di candidate.
E quote section 221 of di constitution and immediately order di PDP to send names of pipo wey go replace dem to INEC to conduct fresh elections.
For di ruling, di Justice also order INEC to stop to recognise David Umahi and Eric Igwe as Govnor and Deputy for Ebonyi State.
End of Di one wey oda users dey read well well
But for press briefing wey di govnor do wit tori pipo, Umahi say di court no get di power to remove am from office.
"Na three ways any govnor fit comot for im seat, either by death, resignation or impeachment by di House of Assembly.
No oda constitutional provision dey wey empower a hatchet man to turn di law and di constitution upside down , I don listen to di judgement of Ekwo and e dey obvious say im dey on a mission," Umahi tok.
E add say, "di ruling dis afternoon na clear evidence say dis kontri dey inside trouble"

Wia dis foto come from, Other
Wetin di judgement mean?
One of Nigeria Senior Advocate of Nigeria (SAN), Mike Ozekhome, react to di Abuja high court decision to sack di govnor and im deputy.
Oga Ozekhome say, "Di judgement wey dem just deliver today, removing di govnor and deputy govnor of Ebonyi state and some lawmakers na bad judgement wey no fit pass di acid test of appellate jurisdiction becos di govnor and deputy govnor dey entitle to appeal and I no tink di court of appeal go uphold dis kain judgement."
SAN Ozekhome explain say di day dem swear pesin in as govnor or deputy govnor, dat day di pesin no longer belong to im political party.
"Im no longer be property of dat political party. Di vote wey make am govnor, na vote wey dem casr for am., not by one political party, but all di oda pipo including di ones wey no belong to any political party at all."
Wetin constitution tok about removing govnor?
According to di Nigeria Constitution, once pesin become govnor, you only fit remove am in di following ways:
- One na section 180 of di 1999 Constitution. For di section, e say pesin fit hold di position of govnor of a state for four years until wen im successor take im oath of office to succeed am.
- Two, e fit stop being govnor wen im die while im dey office
- Three, e fit stop to be govnor wen im resign by imsef from office.
- Four, e fit stop being govnor under section 188 of di constitution wey deal wit di removal of govnor or deputy govnor from office through impeachment.
Oga Mike Ozekhome (SAN) say aside from dis four ways wey constitution don already give, you no fit remove govnor for exercising im right to defect or port from one political party to anoda.
Im add say: "E fit dey painful, unconscionable or immoral for pesin to defect from part wey cari am enta power, but under our law, once pesin become govnor, e no longer belong to im party."
How PDP react
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
In line wit di Abuja Federal High Court order, PDP don submit di name of Iduma Igariwe and Fred Udogwu as govnor and deputy govnor of Ebonyi State to Independent National Electoral Commission (INEC).
National chairmo of di party Iyorchia Ayu say dem select dem afta plenti consultation witin di party and in line wit di court order for di party to submit replacement for both di govnor and deputy seat.
Wetin APC tok
APC meanwhile don also reject di ruling as dem call am reckless.
"Di Presiding Judge commit judicial error by giving judgement wey sack a duly elected and sworn-in Governor and im Deputy without relying on or citing any provision(s) of di constitution of di Federal Republic of Nigeria or any provision of di Electoral Act wey empower di court to sack a sitting Governor and or im Deputy. Dis na purely error of justice," dem tok.
Oda time dis kain tin happun
Last month, federal high court for Zamfara strike out suit wey some Peoples Democratic Party (PDP) members bring unto say make court sack Govnor Bello Matawalle due to im defection to All Progressives Congress (APC).
Di PDP members bin want make court sack Govnor Matawalle as dem believe say na PDP get di govnor seat and im defection to anoda party make am suppose vacate di govnor seat.
According to di court, even though dem no get jurisdiction to listen to di case but di 1999 constitution no stop govnor from moving from one party to di oda.
Judge Bappa Aliyu say Nigeria constitution give any govnor di freedom to move from one party to anoda as long as dat party dey operate legally within Nigeria.
On 1st of August 2018, Sokoto state govnor announce im defection from di ruling APC to PDP for wetin e describe as 'prison yard' democracy wey di ruling party dey practice.
APC sue di govnor go court asking am to vacate di seat because na di party own am. But notin comot form di mata as Govnor Tambuwal finish im term as govnor despite di challenge and still win second term as Sokoto govnor.
Who be Dave Umahi
Born David Nweze Umahi, im na two term govnor of Ebonyi state - e become govnor for 2015 under after e win di election on di platform of im former party, Peoples Democratic Party (PDP).
E later join di All Progressive Congress (APC) for 2020.
Umahi enta politics early and by 2007 e become di acting chairman of di Ebonyi State chapter of di PDP.
From 2009 to 2011 e serve as state chairman of the party.
Oga Umahi later serve for di governing board of di Federal Medical Centre for for one year.













