David Umahi: Governor Umahi join APC for Ebonyi State sake of dis reasons

David Umahi:

Wia dis foto come from, David Umahi:

David Umahi, di Ebonyi State Govnor for eastern Nigeria formally announce today say im dey leave di kontri main opposition Peoples Democratic Party [PDP] to join President Muhammadu Buhari ruling party APC party, formally.

"I leave PDP because of injustice", Govnor Umahi confm give tori pipo for Abakaliki, di state capital on Tuesday.

Dis na as tori bin dey fly upandan say e bin port to seek presidential bid from di APC. For press conference with tori pipo, Govnor Umahi say no be wetin happun on top say im dey plan to comot politics for 2023 as im no identify imsef as politician.

Dis dey come afta days of tori say e go port.

David Umahi

Wia dis foto come from, David Umahi

Wetin we call dis foto, E say e wan quit politics for 2023 so no be presidency dey do am

Two main reasons make Gov. David Umahi decamp from PDP join Buhari APC

As Protest

"I port in protest for di injustice wey dem don see for PDP hand." na wetin oga Umahi tok.

E explain say, with di way south easterners don dey support PDP, sotay at one point di five south eastern states bin dey for dem, e no make sense say since 1998, dem neva consider south east to run for presidency.

Dave Umahi

Wia dis foto come from, Ebonyi Goment

Say im no gree badmouth Buhari

"For PDP, my only sin na say I no tok bad about oga Presido and till thy kingdom come I no go do am", na anoda reason im give.

E tok dis one as im say im no go badmouth PDP for wetin happun because e no dey im character.

E explain say no be for im family character to badmouth pipo but some pipo wey no get character bin dey tink say "because I no dey castigate di goment mean say I go leak PDP secrets."