Coup: We no go sanction Burkina Faso, tok Ecowas

Wia dis foto come from, Twitter
West African leaders don decide say dem no go add more sanctions or punishment on Burkina Faso afta coup wey happun for di kontri last month.
West Africa leaders pass dis resolution for di emergency summit wey dem bin hold for Ghana capital Accra on Thursday afta military take ova for Burkina Faso.
Instead di leaders call for short transition to civilian rule and di release of di elected President Roch Kaboré wey dem remove.
Last year di 15-member kontris community bin sama sanctions on Mali and Guinea afta military takeovers for dia.
In addition to di kasala wey dey happun for di region dis week na di coup attempt for Guinea-Bissau.
Mali coup dey ginger military takeovers for West Africa
During di summit, Chairman of di Economic Community of West Africa States and president of Ghana, Nana Akuffo-Addo, raise serious concern on di many coup wey dey happun for di region.
Oga Akuffo-Addo say, di coup wey happun for Mali for 2020 na im dey ginger oda military take over for di region.
Di president also want make leaders for di region work togeda to find solution to di problem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Last week, di military for Burkina Faso - wit Paul Hendry Sandaogo Damiba as leader - takeover power.
Dis week, anoda coup attempt happun for Guinea Bissau.
As tins be now, three kontri for di region dey under military rule and dis dey affect achievements of democracy for West Africa.
Di security situation for West Africa dey get worse and dis make di wahala more complicated.
Militants wey get link wit Islamic State and al-Quaeda don increase attacks for di Sahel region.
Sabi pipo say, dis development show say di political leaders don fail to solve simples problem for dia pipo.
meeting in the Ghanaian capital, Accra, have decided not to impose further sanctions
West Africa kontris under military rule since 2020
Burkina Faso become di number three kontri to land under di control of di military since September 2020 wen military takeover di first west Africa kontri in recent times.
January 2022
Burkina Faso army announce on January 25 say dem don remove President Roch Marc Christian Kaboré from office, suspend di constitution and seize control of di kontri.
Few days later, di military say dem restore di constitution plus appoint di coup leader as head of state for di transition period. But dem no tok how long di transition period go last.
Dis decision to restore constitution happun not long afta Africa Union suspend Burkina Faso.
September 2021
Elite soldiers for Guinea bin ginger pipo to protest den later announce nationwide curfew "until further notice plus replacement of di kontri regional goment by di military.
Videos wey bin go viral for social media early on Sunday morning bin show soldiers as dem surround di elected President, Alpha Conde.
Di military leaders no let President Conde to leave di kontri on exile.
September 2020 and May 2021
Mali experience two coups inside one year.
For September 2020 Mali military wey Colonel Assimi Goita lead overthrow President Ibrahim Boubacar Keita afta mass anti goment protest.
Nine months later di same Goita lead army for second coup. Dem detain President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane just few hours afta dem announce new cabinet wey no include two main military leaders.
Colonel Assimi Goita afta di first coup, become Ndaw deputy for di transitional administration wey dem form late September 2020.
Mali constitution later name Goita di interim president.











