US comot Islamic State leader from battlefield for Syria raid

Wia dis foto come from, EPA
United States President Joe Biden don announce say one US special forces raid wey happun for north-western Syria target di leader of di jihadist group Islamic State (IS).
"Thanks to di skill and bravery of our armed forces, we don comot Abu Ibrahim al-Hashimi al-Qurayshi, from di battlefield" Biden tok for one statement.
One senior US official tell US tori pipo say Qurayshi explode bomb wey kill him and im family.
Syrian first responders say 13 pipo, including six children, die for di town of Atmeh wey di opposition dey control.
Tori be say many US helicopters land for di area, wey dey for north of Idlib province and close to di border wit Turkey, around midnight on Thursday (22:00 GMT on Wednesday).
Local pipo say di di soldiers face serious resistance wen dem land wit heavy fire from heavy anti-aircraft guns wey dem mount on vehicles.
Area pipo hear gunfire and shelling for two hours before the helicopters leave.
Tori pipo New York Times report say dem abandon one helicopter afta e develop mechanical fault and dem later destroy am for US airstrike.
End of Di one wey oda users dey read well well
President Biden say all di Americans wey bin dey involved return safely from di operation wey im declare say go "protect America pipo and our supporters, and make di world a safer place."
One AFP news agency tori pesin wey visit one two-storey house wey be like target of di raid say e get scars from heavy fighting wit blood scattter all over di world, window frames tear, ceiling black like charcoal and roof partly collapse.
Di White Helmets, wey dem dey also call di Syria Civil Defence, tok for statement saay dia first responders reach di building around 03:15 and recover 13 deadi body, including six children and dour women.
Di Syria Observatory for Human Rights, wey be UK-based monitoring group also say 13 pipo na im die, but according to dem, na four children and three women die.
Dem also find one injured girl wey her oda family members bin die for di raid. dem cari her and one oda man wey wunjure as im bin dey waka near di building during di clash go hospital.
One US senior official tell tori pipo Reuters news agency say: "For di beginning of di operation di terrorist target explode one bomb wey kill am and members of im own family including women and children."
"As we bin still dey assess di result of di operation, dis one be like di same coward terrorist tactics wey we see for di 2019 wey eliminate al-Bagdadi," im add.
Abu Bakr al-Baghdadi, wey bin be leader before Qurayshi, kill imsef and three children for October 2019 by exploding explosive vest during one US special forces raid for one hideout wey dey only 16km away from Atmeh.
North-western Syria na stronghold of jihadist groups and rebel groups wey Turkey dey support wey be serious rivals of IS.













