Stanley Okoro death: Nollywood actor Stanley Rabbi Okoro wey die at 29 - Profile

Stanley Okoro death: Nollywood actor Stanley Okoro wey die at age 29 - Who e be?

Wia dis foto come from, @officialrabbio/Instagram

Read am in 1 mins

Nollywood actor Stanley Rabbi Okoro death at di age of 29 shock Nigeria entertainment industry.

Stanley Okoro na one of Nollywood fast growing prominent talents wey many sabi as Junior Ibu or Stanley Rabbi O.

Okoro die on Wednesday August 11, afta im get wetin dem suspect be a case of food poison.

one day before im die, di young man bin post for im Instagram say "If money when you get no fit solve your problem, my brother chop."

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Who be Stanley Okoro?

Stanley na one of Nigeria fast-rising actors and one of di funniest for Nollywood.

Okoro na di CEO of 27ELEVEN entertainment and apart from being actor, im na MC, promoter, content creator, brand influencer, and digital marketer

Feems wey im act include comedies like "The Briefcase", "Marriage War", "Royal Tigress" and "Behind di Mask."

Oda movies wey im bin shoot before im die include "Order of di dragon", "Abada na South" and "Pocket Book."

Dem born Stanley Okoro on di October 10, 1992. Im die at di age of 29 year on 11 August 2021.

Although im bin live for Owerri di capital of Imo State, Okoro na from Enugu State.

Stanley na graduate from Benue State University.