Twitter ban in Nigeria update: Government make fresh announcement on Twitter ban

"Nigerian Twitter ban"

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria ban land afta Twitter remove Buhari tweet

Goment plan to lift di Twitter ban in Nigeria very soon.

On 5 June 2021, di Nigerian goment officially put an indefinite ban on di microblogging service.

Federal Goment restrict Twitter from operating inside di West African kontri after di social media platform delete tweets by President Muhammadu Buhari.

Nearly 10 weeks later, di kontri Information Minister, Lai Mohammed, give di strongest indication say goment go lift di ban "in a mata of days."

Twitter ban in Nigeria update: Government make fresh announcement on Twitter ban

Wia dis foto come from, Lai Mohammed

Wetin we call dis foto, Lai Mohammed, Nigeria Minister of Information

Di minister tok dis one afta dem finish di Federal Executive Council meeting on Wednesday for Abuja.

Lai Mohammed tell tori pipo say dem still dey do tok-tok wit di social media company.

And dem don reach di advanced stage and di minister add say "peaceful solution dey very much in sight."

According to di minister, some of di goment conditions to end di ban include say Twitter must register dia business for Nigeria.

Twitter go get staff for di kontri plus agree to pay tax to di authorities., di Nigerian goment official add.

Twitter ban in Nigeria update: Government make fresh announcement on Twitter ban

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Logo of Twitter for dia New York office

But Lai Mohammed add say, di goment and Twitter don make "massive progress" towards ending di dispute soon.

Nigeria goment bin ban Twitter afta di platform remove President Muhammadu Buhari post say e dey against dia "abusive behaviour" policy.

Inside di post, President Buhari bin say dem go treat Biafra separatist for southeast of di kontri for "language wey dem go understand".

Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan

Wia dis foto come from, Jack Dorsey

Wetin we call dis foto, Twitter CEO Jack Dorsey wit staff of one tech company Andela for Lagos Nigeria wen e visit di west African nation in November 2019

Some pipo bin interpret di statement to mean say im dey threaten violence.

Im also mention di kontri deadly 1960s deadly civil way wey similar make of wanting to breakaway to creat Biafra state cause.

Nigeria goment sha tok say dem no ban Twitter sake of say di company remove Buhari tweet, but to save di kontri national security and unity.

Activists bin criticize di ban say na way of preventing freedom of speech.

Even wit di ban wey don dey for more dan two months, many Nigerians continue use Twitter through Virtual Private Network (VPN).