Kaduna primary school kidnapping: Gunmen kidnap teachers for Birnin-Gwari Kaduna

Empty classroom of di Government Science College wia gunmen kidnap students and staff for Kagara, Niger State.

Wia dis foto come from, Getty Images

Na only three primary school teachers na im kidnappers gbab for UBE Primary School for Rama village in Birnin Gwari Local Government Area of Kaduna State according to goment officials.

Authorities say dem no kidnap any pupil unlike wetin earlier reports bin tok.

Meanwhile, one of di teachers of di school tell Daily Trust say di pupils escape wen di bandits attempt to tiff some cows and motorcycles for one nearby community.

Naomi Francis, one teacher for di school, wey escape from di kidnappers tell tori pipo for Daily Trust say three pupils regain dia freedom but tok say di bandits beat dem before dem fit escape.

"Dem come in after di morning assembly. We do already enta di classrooms wen six of di bandits come wit motorcycles and others surround di school.

"I bin step out from my class wen I notice students of primary 5 and 6 dey run comot, I immediately alert my students to run and dem run."

One resident, Mai Saje Rama, also confam say di pupils don return to di community.

"Di vigilante wey run after dem came back without success, dem no fit locate di bandits,", he tok.

Samuel Aruwan, di Commissioner in charge of Security for Kaduna bin confam di kidnap earlier say authorities dem no sabi how many pipo di bandits kidnap.

Since December last year, more dan 700 students na im bandits and armed men don kidnap across Nigeria.

But dis na di first time primary school dey become target.

More dan thirty students - mostly young women - wey dem abduct from di Federal Forestry College for Kaduna on Thursday last week still dey kidnappers hand.

Meanwhile officials for Kaduna state tok for weekend say dem burst anoda attempted raid on one secondary school.

Recent school kidnappings in Nigeria:

11 March - 39 na im dem gbab from dia college for Kaduna state

26 February - 279 schoolgirls kidnapped from Jangebe, Zamfara state

17 February - One student killed; 42 staff, students and family members kidnapped from Kagara, Niger state

25 January - Gunmen kidnap seven children from one orphanage for di capital, Abuja

19 December - More dan 80 schoolchildren kidnapped from Mahuta village, Katsina state

11 December - More dan 300 boys kidnapped from one school for Kankara, Katsina state

All don regain dia freedom, except dem kidnap on 11 March.

We don update dis tori.