Mando Kaduna kidnapping: Federal College of Forestry Mechanisation students kidnappers kidnap dozens, military rescue over 100

"Mando Kaduna Forestry school kidnapping": Gunmen attack Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna
Wetin we call dis foto, Na Nigeria Federal Government dey operate di Federal College of Forestry Mechanisation inside Mando area of Kaduna State.

School management of di Federal College of Forestry wia gunmen kidnap some students on Friday for Kaduna, north west Nigeria don shutdown di school till further notice.

Dis one dey come as Kaduna State goment confam say e reach 30 students wey gunmen gbab from di school.

Di State Commissioner of Security, Samuel Aruwan, tok for statement on Friday morning say di whereabouts of 30 students still dey unknown.

Nigerian Army don however rescue 180 pipo, most of dem college be students, Aruwana add.

"Di Nigerian army don successfully rescue 180 pipo; 42 female students, eight teachers and 130 male students.

But about 30 oda male and female students still dey yet to be identified," Aruwan said.

Many gunmen storm di school around 11:30 pm on Thursday night, where dem kolobi several students and teachers.

Kaduna kidnapping: Federal College of Forestry Mechanisation students kidnappers kidnap dozens

Wia dis foto come from, Kaduna State Govt

Wetin we call dis foto, Some of di rescued students

Kaduna Forestry school kidnapping - Gunmen say dem kidnap dozens

Gunmen wey attack students for Federal College of Forestry Mechanisation, Mando for Kaduna State last night bin use bus storm di school and kidnapp dozens of students.

Di armed men bin kolobi more than thirty students at once, according to latest update BBC Pidgin find out.

One of staff of Federal College of Forestry Mechanisation say di kidnappers ask one of di kidnapped students to call a staff and inform dem say di gunmen dey wit more than thirty students for wia dem kolobi dem go.

Witnesses say di gunmen storm di Federal College of Forestry Mechanisation wey dey di outer area of Kaduna city, where dem bin open fire and kidnap a number of students from dia hostels.

Eget one airport and a train station inside dis area wia di kidnapping for Mando Kaduna.

Sojas alias troops wit tanks and helicopter na im dem don send to try to rescue di students wey di gunmen kidnap.

Mando "Kaduna State" kidnapping

Wia dis foto come from, Kaduna State Government

Wetin we call dis foto, Kaduna State Governor say dem don inform families of di students on dis security security emergency.
"Mando Kaduna Forestry school kidnapping": Gunmen attack Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna

Mando Kaduna Forestry school kidnapping - How gunmen kidnap di students

Di actual number of students di gunmen carry go on Thursday night still dey unclear.

But Commissioner for Internal Affairs for Kaduna State, Samuel Aruwan tell BBC say dem dey inside di school at di moment and dey try collate numbers and everything wey happun.

One student wey speak to BBC say di gunmen enter di school for night and na only female students dem carry go and no touch any of di male students.

Although goment officials neva confam wetin she tok for now.

However, tori be say those wey bin dey di female hostel bin hide but di armed men still go inside di hostel and pick dem up.

BBC Pidgin find out say di male student, many of dem bin fit escape.

One of di staff of di school say di management of Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna don bin dey worried about di safety of di students.

Some days back, one family of 10 na im jaguda pipo bin kidnap around di community wia di school dey located, di staff reveal.

"Mando Kaduna Forestry school kidnapping": Gunmen attack Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna

Dis na fourth case of students kidnap from school in recent times after e happun for Kankara, Kagara and Jangebe towns all for north-western Nigeria.

A resident of Mando area wia di school dey located for Kaduna city tell BBC say dem hear gunshots around 11pm until 12am but just assume say na from Nigeria Defence Academy wey dey close, say maybe dem dey do training.

"We dey close to Nigeria Defence Academy and sometimes we dey hear gunshots during their training, so we just think say na dem not knowing wetin dey happun."

BBC Reporter wey shaparly reach di school on Friday morning say security pipo don full dia and don start investigation work.

"Mando Kaduna Forestry school kidnapping": Gunmen attack Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna
"Mando Kaduna Forestry school kidnapping": Gunmen attack Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna

Di school get hundreds of students. Dis na di fourth case of kidnappings of students in di last 3 months.

Parents and relatives don gada for di school premises on Friday morning to see whether dia pikin dey safe - or not.

No group don claim responsibility on dis fresh attack on di Federal College of Forestry Mechanisation Kaduna wey dey near one Nigerian military training school.

Jaguda pipo wit guns don dey target schools for Nigeria so as to kidnap students for money.

Around 800 students na im don dey kidnapped since December inside different-different operations.

After negotiations with di gunmen, di students go get dia freedom back.

Summary of wetin we know so far

  • Kidnappers refuse to tok wit school management say dem go yan wit di Federal goment
  • Di bandits no enta through di school gate, dem drill large hole through di fence to attack di student.
  • Dem trek into di school through di school dam area
  • Di first place dem attack na di male dormitory.
  • Di student bin dey prepare for exams and some of dem bin gada dey prepare togeda.
  • One student bin escape and alert oda students dem and also military pipo wey dey di road wey dey go railway
  • Di military come mobilise and begin engage dem but di armed men position pipo to also engage di military.
  • Sake of di engagement, di bandits no fit cari plenti students
  • Dem say di bandits reach like forty pipo