Sean Connery: James Bond actor die at di age of 90

Sir Sean Connery

Wia dis foto come from, Reuters

Sir Sean Connery don die at di age of 90, im family tok.

Di British actor wey bin dey popular for acting James Bond, be first to cari di role enta big screen and im act for even of di spy thrillers.

Sir Connery die for night inside im sleep as im dey for Bahamas. Tori be say im bin no well for some time.

Im act for many many years and bin win many awards including Oscar, two Bafta awards and three Golden Globe awards.

Di "Diamonds are Forever" actor bin act oda feems like di Hunter for Red October, Indiana Jones and di Last Crusader and di Rock.

Sean Connery

Wia dis foto come from, Getty Images

Many still dey see am as di best actor to eva play di role of 007.

Im Oscar come for 1988, wen dem name am di best supporting actor for di party wey im play as Irish police for The Untouchables.

Di Queen of England make am Knight for 2000 for Holyrood Palace.

Sean Connery celebrate bin celebrate im 90th birthday for August.

Sharp-sharp tins to sabi about Sean Connery

  • Sir Thomas Sean Connery bin act for seven different James Bond feem between 1962 and 1983.
  • Dem born am for Scotland on 25 August 1930 to im mama wey be cleaner and im papa wey be lorry driver.
  • Though na di James Bond feem make pipo sabi am wella, im bin don dey work for di entertainment industry since di 50s as backstage boy.
  • All di James Bond feem wey im act bin dey very successful sotay, di American Film Institute select am as di third-greatest hero for cinema history.
  • Even though fans bin turn Connery to dia idol, many pipo no know say di James Bond role bin tire am afta some time. Im padi and fellow actor, Michael Caine bin tok say, "If you be im friend, no just bring up anytin James Bond. Im sabi act oda roles apart from James Bond".

But no be only James Bond im bin act as. Dis na some oda feems wey Connery bin act.

  • Marnie (1964)
  • The Hill (1965)
  • Blowup (1966)
  • The Man Who Would Be King (1975)
  • Robin and Marian (1976) as Robin Hood

Di ogbonge actor also win awards for im looks including "Sexiest Man Alive" for 1989 and di "Sexiest Man of the Century" for 1999 by People Magazine.