Mercy Baguma Glasgow: Cause of death of dis Govan asylum seeker from Uganda wey UK police find deadi bodi next to her pikin wey dey starve na im many dey wonder

Wia dis foto come from, Postive Action in Housing
Mercy Baguma death inside Glasgow na im UK police don begin investigate to sabi wetin kill her afta dem find asylum seeker from Uganda deadi bodi near her pikin wey dey starve.
Authorities find di deadi bodi of Mercy Baguma, wey from Uganda, for her flat Glasgow on Saturday 22 August afta pipo her di sound of her pikin cry.
One police tok tok pesin say dem dey treat her death as sometin wey dem never fit explain but e no dey suspicious.
Refugee Charity Positive Action in Housing say madam Baguma bin claim asylum and bin live for "extreme poverty."
Di charity organisation say she loss her work afta her paper to work for UK expire.
Dem find her one year old son next to im mama dey cry and im bin dey "weak due to several days of starvation," according to Robina Qureshi, director of Positive Action in Housing.
Im say dem cari di boy go hospital come discharge am on Monday 24 August, and now in dey stay wit im papa.
Di situation na tragedy
Di charity organisation say madam Baguma bin contact dem some weeks ago to say she no get enough moni to look afta hersef and her pikin.
End of Di one wey oda users dey read well well
Anoda charity, African challenge Scotland, post video for social media wia Baguma dey tank some volunteers for food wey dey come delivery for her house for June.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

One Home Office tok tok pesin say: "Dis situation na tragedy and we dey greet madam Baguma family."
E add say: "Di Home Office dey take di wellbeing of pipo wey dey asylum extremely seriously, and we do full investigate for madam Baguma case.
Friends and relatives begin worry wen dem no fit communicate wit madam Baguma on Tuesday 18 August.
Madam Qureshi say: "Why e be say dem dey allow mama and pikin dem to starve for dis city, and why e be say dem leave am for charity and volunteers to pick di pieces?"
She add say: "Dis mama for still dey alive if to say dem no force am to stop work sake of dis wicked system wey go stop you from work and paying for wetin you want sake of one small paper say make you waka becos you right to stay don expire? I sure say Mercy pikin go wan ask dis plus oda questions once im grow up."

Call for investigate
Positive Action in Housing say madam Baguma death na di last tragedy to hit Glasgow refugee community in less dan four months.
Police shoot kill one man afta im stab six pipo including one police officer for di Park Inn hotel on Friday June 26.
For Beginning of May, dem find di deadi bodi of one Syria refugee, Adnan Walid Elbi, for im room for one temporary hotel accommodation for Glasgow.
Glasgow City Council convenor for equalities and human rights, Jen Layden, say: Di tragic death of di young mama dey shocking and my heart dey go to Mercy family and friend - including her small pikin - for dis sad time.
"We dey try gada di full fat about Mercy case and we dey wait for additional informate from Home Office and Mears," she tok.













