Rape in Nigeria: ‘My papa rape me for many years from wen I just clock 8, now I wan fight

Wetin we call dis Video, Rape in Nigeria: ‘My papa rape me for many years from wen I just clock 8, now I wan fight

Producer: Andrew Gift, Chukwuemeka Anyikwa

Dis young Nigerian lady papa begin rape her wen she be around eight years old.

Di papa cut her warning say e go flush Martha( no be her real name) for toilet if e tell anybody about dis.

Martha father also tell her say if she eva open her mouth, e go stop to pay her school.

Sake of dis, Martha no fit tell her mama, she come begin dey live in fear, anger and pain.

From eight years wen her papa begin rape her, e last till she be 15 years old.

Di only way for Martha to calm her pain na to write down wetin her papa dey do am for diary.

But later her neighbours epp her escape and report di mata to police.

Her mother and brodas dem abandon her and di only evidence she get to prove say her papa truly rape her na her diary.

Her dream na to study hard to become lawyer to fight and get justice for rape victims.