Kenosha shooting: Jacob Blake - Full tori of wetin we sabi about dis black man for United States

Kenosha shooting

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Protesters set vehicles on fire in Kenosha
Read am in 2 mins

Jacob Blake, 29 years old black man, dey fight for im life afta di United States police for Wisconsin shoot am.

Police say dem bin dey respond to "domestic incident."

Pipo wey cari eyes see tell local tori pipo say, Jacob bin dey try separate fight between two women and police bin try to use Taser shock am be for dem begin shot.

Map

Di video wey circulate for social media, show say even though Jacob bin no cari any weapon at all, police still shoot am for back seven times in front of three of im small pikin dem.

One prominent human right lawyer Ben Crump write for Twitter say oga Jacob three sons bin dey inside di ar as police dey shot dia papa.

"Dem see police shoot dia papa. Dem go dey traumatised forever. We no fit let officers disrespect dia duty to PROTECT us," im write.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Protesters enta road

Hundreds of pipo bin enta road for di Wisconsin town of Kenosha, to do I-no-go-gree sake of di shooting.

Di protesters match go police headquarters on Sunday. Dem burn-burn motor and dem bin dey shout "we no go gree."

Authorities declare emergency overnight curfew to calm tins down.

Police also do public safety alert announcement dey advice pipo wey get 24hours shop to close becos dem bin get "plenty" calls about armed robbery and shooting.

Inside im statement, Govnor of Wisconsin, Tony Evers, condemn di shooting come add say "although we neva sabi exactly wetin happun, wetin we know be say dis no be di first black man or pesin wey dem don shoot or wunjure or mercilessly kill for di hands of some pipo wey dey work for law enforcement for our state or our kontri."

Wetin we call dis Video, George Floyd: Black Lives Matter speech dem wey go viral

Wetin happun?

Kenosha Police Department say di shooting around 5pm local time on Sunday. Dem add say police sharply provide "help" to oga Blake before dem cari am go hospital.

Dem say police bin dey respond to "domestic incident" but e no give any informate about wetin cause di shooting.

Den still neva release di names of di officers wey dey involved but say dem don send di officers go administrative leave.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

For video wey dem share for social media, you fit see three policemen dey point dia gun at oga Jacob as im dey waka round on jeep. As im open di door lean inside di car, one policeman drag im shirt begin fire. Seven gun shoots n aim you go hear for di video as pipo wey dey around dey shout and scream.

E neva too tey wey di whole US catch fire as hundreds of thousands of pipo enta road during coronavirus lockdown for May sake of police killing of George Floyd.

Floyd na black man wey die for police hand for Minnesota afta police man knee on top im neck for almost nine minute before im die.