Buruji Kashamu: Why Obasanjo tribute to di late senator vex kontri pipo

Olusegun Obasanjo

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

Di tribute wey former President Olusegun Obasanjo write for di death of Senator Buruji Kashamu don make pipo dey para.

Inside im statement wey im tok-tok pesin Kehinde Akinyemi sign, Obasanjo say while Kashamu death dey "sad", im life and history bin leave "lessons for those wey dey on dis side of di veil."

Kashamu die of Covid-19 on Saturday, 8 August for First Cardiology Consultants hospital inside Lagos, according to im friend Senator Ben Murray Bruce.

"Senator Buruji Kashamu for im lifetime, bin use law and politics to dodge from accuse of criminal offence for Nigeria and outside Nigeria," Obasanjo tok.

"But no legal, political, cultural, social, or even medical corner corner fit stop di cold hand of death wen di Creator of all us decide say im time don finish.

"Make Allah forgive im sin and accept im soul inside Aljanah, and may God grant im family and friends di strenght to bear di ogbonge loss."

Statement

Wia dis foto come from, olusegun obasanjo

BBC bin follow im tok-tok pesin Akinyemi yan, wey insist say Obasanjo dey "entitled to im opinion about anybodi (dead or alive)". Im add say pipo wey dey para for Obasanjo ontop social media also get dia mouth and im no regret wetin im write.

Until im death, Kashamu na Nigerian politician wey serve as a Senator representing Ogun East inside di 8th National Assembly.

How pipo dey para for social media

Ayodele Fayose, Ekiti state former governor wey pray for di late senator, say condemn Obasanjo statement.

Many odas for social media no gree wit di statement wey di former presido make.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

But some odas stand gidigba wit Obasanjo statement.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

Skip X post, 5

End of X post, 5

Some of di kwanta wey Kashamu bin get wit di law

  • 1998, court for America bin accuse am of plan to import heroin enta US
  • 2015, National Drugs Law Enforcement Agency (NDLEA) bin waylay Kashamu for house to arrest am send am go US but local reports be say Kashama no gree come out afta dem wait for am for six days.
  • 2016, court for Chicago, Illinois rule say Kashamu must answer im drug accuse