Ajimobi burial: Senator Abiola Ajimob, Oyo ex-Govnor die for coronavirus complications - See wetin we sabi about im death & burial

Senator Abiola Ajimobi

Wia dis foto come from, Abiola Ajimobi

    • Author, Olubunmi Okunnu
    • Role, Broadcast Journalist
  • Read am in 4 mins

Abiola Ajimobi, di former govnor of Oyo State south-west Nigeria die from multiple organs failure following complications from COVID19 infection and BBC Pidgin find out say im burial go now take place for on Sunday.

Na exactly 10:05am on Sunday na im Senator Abiola Ajimobi deadi bodi enta grave, in di presence of im family for im house garden wey dey Oluyole for Ibadan, capital of Oyo State, South West Nigeria

Only di family members of di former govnor and staff of Nigeria Centre for Disease Control dey di venue of di burial, according to wetin BBC Pidgin sabi.

Ajimobi burial: Senator Abiola Ajimob, Oyo ex-Govnor die for coronavirus complications

Wia dis foto come from, OTHER

Wetin we call dis foto, Senator Abiola Ajimob, Oyo ex-Govnor die for coronavirus complications for Lagos

Di family bin say dem go bury Ajimobi wey die at di age of 70 on Friday for Ibadan, di Oyo State Capital, but Bolaji Tunji wey be di PA to di late Senator Abiola Ajimobi tok say dem pospone am sake consultation wit Lagos and Oyo State goments.

"Di burial e go dey observed privately so dat e go dey in line wit di Nigerian Centre for Disease Control (NCDC) guidelines." Tunji add on Friday.

"If notin change last minute, dem go bury am for Senator Ishaq Abiola Ajimobi Central Mosque inside Oke Ado, Ibadan at 12 O'clock for afternoon on Sunday, 28th of June, afta di traditional Muslim prayers." Oga Tunji tok for statement on Friday.

Na one close aide of di Senator and anoda family member first confam Ajimobi death to BBC on Thursday evening of 25 June.

Senator Abiola Ajimobi die for First Cardiologist Consultant; one private hospital inside Lagos, wey goment give approval to operate as Coronavirus COVID19 care facility, according to Professor Akin Abayomi, di Lagos State Commissioner for Heath.

Oda of im close friends don begin post sorry messages of im death. Nigeria President Muhammadu Buhari mourn di death of Ajimobi for statement from im office.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Otunba Adebayo Christopher Alao-Akala, di former Oyo govnor wey Abiola Abiola Ajimobi succeed tell BBC im dey in shock over di death of di man wey take over from him.

Abiola Ajimobi dies at 70

Wia dis foto come from, Other

Oga Ajimobi dead mata land afta di former govnor spend weeks in coma inside intensive care for coronavirus complications, according to wetin Akin Alabi wey be federal lawmaker and political associate of di late senator tok.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Senator Abiola Ajimobi burial inside fotos

urial venue for Ajimobi

Wia dis foto come from, Other

According to report and sources of BBC Pidgin wey dey di venue, na only di family enter di burial place sake of di guideline of di Nigeria Centre for Disease Control wey say na only 25 pipo fit dey burial.

urial venue for Ajimobi

Wia dis foto come from, Other

BBC Pidgin no fit confam independently if na only 25 pipo dey inside di burial place.

Pipo wey attend Ajimobi burial

Wia dis foto come from, Other

E be like say pipo pack for street as dem dey bury am

Wia dis foto come from, Other

Senior leaders wey dey di burial be Chairman of all Muslim groups in Oyo, Alhaji Kunle Saani, Sheikh Muiydeen Bello, Ibadan Community Leaders, Sheikh Abubakar Abdul Ganiyu Partner and others.

12 O'clock dem go do prayer for di late govnor for Senator Ishaq Abiola Ajimobi Central Mosque in Oke-Ado.

Abiola Ajimobi dies at 70

Wia dis foto come from, TTwitter/@AAAjimobi

Who be Abiola Ajimobi?

Dem born am as Isiaka Abiola Ajimobi on 16 December, 1949.

Na for im state of origin Oyo, im do im primary and secondary education.

Ajimobi travel go America for im university education wia im study Business Administration and Finance for State University of New York and later do MBA for State University, Illinois.

E marry Florence 1980 and dem get five children.

Im political career begin for 2003 when im bin serve as Deputy Minority leader for Senate. By 2007 im contest to be govnor of Oyo State but e no win am.

For 2011, e become govnor for di first time, and later e break record for Oyo to be di first pesin to do two democratic terms back-to-back for di state.

Abiola Ajimobi

Wia dis foto come from, Abiola Ajimobi

Around 18 June, rumours bin dey fly upandan say di lawmaker and former govnor don die, only for im daughter Fatima Ganduje-Ajimobi to comot for social media to deny am.

Inside interview with BBC Yoruba on Tuesday, 16, June , 2020, im tok-tok pesin Bolaji Tunji tok say 'Ajimobi say im go settle all di wahala wey dey di political party during dia National Executive Council (NEC) meeting'.

Oga Tunji also bin deny all di rumours wey dey fly around say senator Ajimobi dey coma and dey receive treatment for hospital.