Hushpuppi extradition: Who be Woodberry wey Dubai police arrest wit Ramoni Igbalode

Olalekan Jacob Ponle wey pipo also know as Woodberry one of di internet fraudster Dubai police arrest

Wia dis foto come from, MRWOODBERRY/TWITTER

Wetin we call dis foto, Olalekan Jacob Ponle wey pipo also know as Woodberry one of di internet fraudster Dubai police arrest
Read am in 2 mins

People dey wonder who be di Mr Woodberry wey Dubai police extradite go America alongside Hushpuppi, di Nigerian internet celebrity wey Dubai police catch ontop accuse of fraud mago- mago for inside United Arab Emirates.

Di Federal Bureau of Investigation (FBI) and Interpol for Dubai bin arrest Ramoni Igbalode aka Hushpuppy and Woodberry wey im real name na Olalekan Jacob Ponle for internet crime wey worth ova N160bn - dat na 1.6 billion dirham to naira.

Di Director of Dubai CID also say from dia raid, dem gbab document of one planned fraud wey dey worth $435 million.

Dubai police for dia twitter handle tok say dem don deport dem give FBI for America.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Olalekan Jacob Ponle wey pipo also know as Woodberry one of di internet fraudster Dubai police arrest

Wia dis foto come from, MRWOODBERRY/TWITTER

Wetin we call dis foto, Olalekan Jacob Ponle wey pipo also know as Woodberry one of di internet fraudster Dubai police arrest

See wetin we sabi about Woodberry

  • Im real name na Olalekan Jacob Ponle, dem born am for May 25.
  • Mr Woodberry na Nigerian socialite and e dey live for Dubai.
  • Woodberry na pesin wey keep im private life private as information about am no too dey.
  • Im Instagram handle na @mrwoodberry and im get about 166,000 followers
  • Di 51 posts wey e put for instagram, showcase expensive cars, travels, clothes wey im flaunt.
  • For im last post for June 8 before Dubai police arrest am on top internet fraud accuse, im bin celebrate im mama birthday wit picture of one white range rover car. He write say "Happy birthday mum, I wan make you know say I be nothing without you but I fit be everything if you dey by my side. I owe you for di thing wey I become today. You be di most special pesin for my life."
Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 1

  • And for im birthday, he post say "you suppose enjoy wetin you work for. No let anybody make you feel guilty for di money wey you don gada, especially if na your blood, sweat and tears you take gada di wealth".
Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 2

  • Mr Woodberry dey always wear two wristwatches

Dem catch di suspects for one series of synchronised raids by six SWAT teams from Dubai Police who spoil di plan of di gang to deceive plenti people from around di world and steal dia moni.