Coronavirus cure: Wen we fit expect vaccine for COVID-19?

Wetin we call dis Video, Scientists tok say we fit get vaccine for coronavirus like dat kain September dis year.

Even if e dey ready by dis time na world record o. Di tin be say vaccine dey take long time to develop becos wen researchers don find sometin wey dey give correct result, dem gats test am plenty times before e go dey safe for evribodi to use.

Afta dem do dis one, anoda work dey to produce enuf of di vaccine make e reach di whole world.

Well, na so we go dey wait…. For now, no forget to dey do tins like social distancing and no dey go places wia pipo gada demsef like sardine.