ASUU Strike go continue forever - Nigeria University lecturers dey insist

Ajayi Crowder University, Oyo southwest Nigeria

Wia dis foto come from, Other

Nigeria university lecturers vow to continue dia 19 days strike on Friday until Federal Goment agree to all dia demands.

Oga Chairmo of Academic Staff Union of Universities - ASUU for University of Ibadan, Deji Omole tell local tori pipo dis one afta meeting wey happun on Thursday for Federal Ministry of Education, Abuja office ministry, between goment and lecturers.

Dis na di number two meeting to put finishing touches to di negotiation wey dey on to end di strike mata afta di November 15 meeting of university lecturers and goment wey no conclude.

Oga Omole say di strike na sake of wetin don be like failure of President Muhammadu Buhari-goment to fulfil wetin dey inside di agreement dem sign wit di Union for 2017.

Nigeria university lecturers wey don dey on strike since November 5.

Na three reasons dey make university lecturers strike dis time; one na say dem want federal goment to increase moni dem dey give universities; two na say federal goment dey try increase school fees wey student dey pay and three na say dem no want goment to create Education bank.

As tins dey no meeting don fit find solution on how to end di ongoing strike and review di September 2017 Memorandum of Action.

University lecturers don dey on strike since November 5.

Wetin we call dis Video, ASUU don stop work till-thy-kingdom come for Nigeria

See di pishures wey dey make Nigerian University lecturers strike

Empty classroom
Wetin we call dis foto, Histology lab for Medical Sciences Faculty for University of Port Harcourt
Animal house for University of Portharcourt
Wetin we call dis foto, Animal house for department of Plant and Animal Science, University of Port Harcourt
Classroom
Wetin we call dis foto, Lecture hall for Faculty of Sciences for University of Portharcourt
New building
Wetin we call dis foto, New Academic block wey TETFUND dey build for Uniport
Toilet
Wetin we call dis foto, Toilet for Block G male hostel Bayero University, Kano
Students hostel for Bayero University, Kano
Wetin we call dis foto, Students hostel Block G for Bayero University, Kano
Classroom for Bayero University, Kano
Wetin we call dis foto, Classroom for Chemistry department Bayero University, Kano
Lecture hall
Wetin we call dis foto, Lecture hall for faculty of Sciences University of Port Harcourt
Animal Lab
Wetin we call dis foto, Animal Lab for University of Portharcourt