ASUU strike: Di pishures wey dey make Nigerian University lecturers strike

Empty classroom
Wetin we call dis foto, Histology lab for Medical Sciences Faculty for University of Port Harcourt

On Monday, Nigeria President Muhammadu Buhari say goment go increase di moni wey dem dey put for education sake of say di kontri development depend on am.

Nigeria five percent budget allocation to education for 2018, no reach di 26% wey United Nations joinbodi UNESCO recommend.

As e be so, Nigerian Universities dey on strike and one of di tins wey lecturers dey fight for na say make goment add money to improve tins for schools.

Na to torchlight di condition of facilities wey dey Nigerian public schools make BBC Pidgin enta University of Port Harcourt for southern part of di kontri, and di Bayero University for Kano State for north, to see how tins be.

Animal house for University of Portharcourt
Wetin we call dis foto, Animal house for department of Plant and Animal Science, University of Port Harcourt
Classroom
Wetin we call dis foto, Lecture hall for Faculty of Sciences for University of Portharcourt
New building
Wetin we call dis foto, New Academic block wey TETFUND dey build for Uniport
Toilet
Wetin we call dis foto, Toilet for Block G male hostel Bayero University, Kano
Students hostel for Bayero University, Kano
Wetin we call dis foto, Students hostel Block G for Bayero University, Kano
Classroom for Bayero University, Kano
Wetin we call dis foto, Classroom for Chemistry department Bayero University, Kano
Lecture hall
Wetin we call dis foto, Lecture hall for faculty of Sciences University of Port Harcourt
Animal Lab
Wetin we call dis foto, Animal Lab for University of Portharcourt

Biodun Ogunyemi wey be President of di Academic Staff Union of Universities (ASUU) wey be joinbodi of university lecturers for di kontri, tell tori pipo say goment neva begin do tok tok wit dem to settle dia mata.

As dat one dey happun Kayode Fayemi wey be governor for Ekiti state south west Nigeria say di lecturers no suppose do strike unto say di Buhari goment don do beta to dem pass oda administrations. Di govnor say di lecturers no dey use all di opportunities wey dey available for dem to use.

BBC Pidgin bin tok wit students for di University of Lagos, about di strike wey don keep dem for house.

Wetin we call dis Video, ASUU don stop work till-thy-kingdom come for Nigeria