You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria vs Croatia: Only defensive Super Eagles fit stop di Blazers
Nigeria senior football team Super Eagles don finally announce say dem don ready to play dia first game on Saturday against Croatia.
Di match go shelle around 8pm Nigerian time for Kaliningrad Arena stadium.
Di team finally announce on Saturday morning say dem don ready for di game wey dem go play for evening.
Afta dia last friendly match against Czech Republic, Coach Gernot Rohr tok say dem still never ready, so now wen dem don finally ready how today match go be, na wetin Nigerians wan know.
Meanwhile $50 thousand dollars reward dey for evri goal wey super eagles score for Saturday opener against Croatia, according to Nigeria Football Federation - Presido Amaju Pinnick
Only very defensive Super Eagles fit stop di Blazers
'Super Eagles of Nigeria look very good (both for jersey and evritin), according to BBC sports tori pesin Adebola Adebanjo.
'But di question evrione dey asking na if dem go play good football too against team wey strong like Croatia wey follow teams pipo dey eye to go far for di world cup. Croatia get di experience and sabi players wey dey play top level, Ivan Rakitic and Luka Modric follow for some of dia players and na only very defensive Super Eagles fit stop dem.' According to we sports tori pesin.
Di Super Eagles fit use players like Victor Moses, Alex Iwobi, Ahmed Musa, and striker Odion Ighalo wey dey celebrate him birthday for dis match day to threaten di Vatreni (Di Blazers) goal post.
End of Di one wey oda users dey read well well
Adebola also think say dem need to dey organize for all corners, 'make we start with 3-5-2 formation, which mean say we need to get defensive and attacking balance'.
Tori be say Super Eagles of Nigeria na big games players and Croatia go dey hope say dis match no go be one of di days dem go spoil dia show.