Harry and Meghan almost dey involve for deadly car accident

Wia dis foto come from, Getty Images
Prince Harry, im wife Meghan and her mama almost dey involve for "deadly car accident" wey involve tori pipo, one tok-tok pesin to di prince confam.
Di accident happun afta di Duke and Duchess of Sussex attend one award ceremony for New York on Tuesday.
For inside statement, di prince tok-tok pesin say di "continuous pursuit" bin last ova two hours.
Dem add say e remain small make dia motor jam oda drivers for road, pipo wey dey waka and police officers.
Di tok-tok pesin say, "even though to be public figure dey come wit some interest from di public, e no reach to cost anybody safety".
"To share dis images, because of ways dem get am, dey ginger di kain practice wey dey dangerous for everybodi wey dey involved."
Di New York Police Department no immediately confam say dem sabi say di mata happun.
Dis incident dem say happun afta di couple first public appearance togeda since di King Coronation earlier dis month.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem bin attend di Ms Foundation Women of Vision 50th anniversary gala night alongside Meghan mama, Doria Ragland.
Di New York Police Department (NYPD) no immediately confirm knowledge of di mata. Also dem neva give report of any injuries or arrests.
Di awards ceremony - di Ms Foundation Women of Vision Awards - na di couple first public appearance together since di King Coronation earlier dis month. Meghan bin collect one award for dat event alongside LaTosha Brown, di co-founder of Black Voters Matter.
Meghan mama, Doria Ragland bin follow dem go di event. Photographs wey dem take last night show as di group dey comot di ceremony for Manhattan.
Claims dey say pipo wey chase dem involve half a dozen cars, wit reckless driving wey include driving through red lights, driving on di pavement, dem carry out blocking moves, and reverse down for one way-way street - plus dem dey take pictures as dem dey drive.
Di BBC understand say di couple dey stay for one of dia friend house for New York and no come back directly so dat dem no go compromise dia security during di chase.
Claims also dey say di presence of New York police officers no stop di pursuit.
Dem kill Prince Harry mother, Princess Diana, for 1997 for motor accident for Paris as photographers dey chase her.
For one interview wit di BBC for di documentary "Diana, 7 Days", Prince Harry refer to di paparazzi as "a pack of dogs" wey constantly dey pursue im mama. "Every single time she comot, plenty pipo go dey wait for her," e tok. "I mean a pack of dogs, bin follow her, chase her, harass her, call her names, spit on her, as dem dey try to get foto wey go show her dey papa."
At di moment, Prince Harry dey involved for multiple legal disputes wit di British tabloid press, wey include allegations of phone hacking plus di unlawful gathering of information.
Earlier dis week, one lawyer wey dey represent Prince Harry tell one London court say make dem allow am challenge one goment decision wey deny am di ability to pay for police protection wen e dey di kontri.
Di couple bin step down from royal duties and relocate go di US for 2020 - one move dem tok say partly na sake of di harassment from UK tabloids.











