Turkey earthquake: America Netherlands Italy and oda konttries of di world rally to support Turkish and Syria quake victims

Rescuers dey battle heavy rain and snow as dem dey race against di clock to find survivors of di devastating earthquakes for south-east Turkey.

More dan 4,300 pipo don die and 15,000 don injure for Turkey and over di border for Syria wen di quake strike for di early hours of Monday.

Di World Health Organization don warn say di toll fit rise dramatically as rescuers dey find more victims.

As day break, rescue teams dey step up dia search for survivors.

Many pipo for dia disaster zone don dey too scared to go back into buildings.

As Turkey and Syria dey begin assess di damage wey 7.8 magnitude earthquake cause, kontris around di world don mobilise to help di rescue and recovery efforts. So far, na 4,300 pipo don die.

Rain and snow dey affect rescuers, but specialised teams from many nations, including Italy, di US, Israel and Taiwan - dey on dia way.

1px transparent line
Red crescent aid in boxes near di entrance to a plane

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Iraq dey provide aid to Syria. Security forces processes supplies from di Red Crescent aid group to send to di neighbouring kontri.
Three men load one truck wit aid for Syria

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Iraqi soldiers and di Iraqi Red Crescent society workers load trucks with di materials.
One Taiwanese official stand in front of one group of rescuers

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Taiwanese rescuers plan to assist wit search and rescue operations in Turkey.
One group of firefighters load materials inside one plane

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One specialised team of firefighters from di Czech Republic Urban Search and Rescue Team go help search for pipo in di rubble for Turkey.
Dogs sit next to specialised USAR staff for di airport

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Czech USAR team dey specifically trained to find pipo wey fit dey buried under di rubble.
Two Dutch firefighters walk towards airport wit bags and helmets

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Members of di Dutch search and rescue team wan fly out from Eindhoven to provide assistance in Turkey.
One woman cuddles one dog

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, About 50 firefighters and medical workers leave Pisa, Italy, to assist at di Syria-Turkey border wit rescue efforts.
One firefighter stand near suitcases and check one list

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rome tok say further flights go follow afta di firefighters arrive, bringing medical personnel and equipment for Turkey.
One Greek soldier stand near one plane wey dem dey load wit supplies

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Greece prime minister on Monday pledge to make "every force available" to aid dia neighbour Turkey. Dem send supplies and rescuers on one plane on di same day of di quake.
One group of rescuers stand near di entrance to one plane

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Greece and Turkey don historically suffer from various border and cultural disputes.
Two men in one fire truck pass one border check

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bulgarian rescue teams dey deployed across di Kapikule Border Gate to help wit relief efforts across Turkey.
One man stand near aid and check one list for Israel

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di "Olive Branches" aid section of di Israeli Defence Force leave Israel for Turkey to assist wit di earthquake recovery efforts. Israel prime minister also tok say im don approve sending aid to Syria - wey dia goment no recognise Israel.
Men in army uniforms walk on tarmac towards one plane

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Israel receive di request to aid Syria through diplomatic channels. But Damascus deny say dem request assistance.
Four US firefighters pack supplies to go to Turkey

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, US President Joe Biden tok say im teams dey deploy quickly to begin to support Turkish search and rescue efforts.
One US firefighter secure supplies for Turkey

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di US say dem go send two search and rescue teams of nearly 80 pipo each.
At di Turkish embassy for Moscow, dem lay flowers

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, At di Turkish embassy for Moscow, dem lay flowers. One lit candle wit one small poster read "Condolences to Turkey". Russia don offer aid to both Turkey and Syria.
Germany rescue team

Wia dis foto come from, Reuters

Oda world leaders promise support

Nigeria President Muhammadu Buhari commiserate wit di goments and pipo of Turkey and Syria and dose wey lose dia family and friends sake of di earthquake for southern Turkish city of Gaziantep. President Buhari tok say as Turkey and Syria friend, Nigeria dey ready to offer full support for di two kontris in any way.

For Ghana, President Nana Akufo-Addo extend im heartfelt condolences to di goments of di two kontris. E pray for di souls of dose wey don die and pray for di survivors.

Tanzanian President Samia Suluhu also extend her heartfelt condolences as she add say di thoughts and prayers of her kontri pipo dey wit Turkey and Syria.

For Ethiopia, Prime Minister Abiy Ahmed Ali pray for di souls of di deceased for dis difficult time.

United States President Joe Biden say im deeply dey saddened by di earthquakes wey don claim thousands of lives. E say im administration don dey work closely wit dia Nato ally Turkey and im don authorise immediate US response.

Canadian Prime Minister Justin Trudeau also tok sorry to Turkey and Syria sake of di earthquakes and promise say im kontri dey ready to provide assistance.

UK Prime Minister Rishi Sunak say di kontri stand wit Turkey and Syria and dem ready to help in whatever way dem fit.

Germany Prime Minister Olaf Scholz say im kontri go send support to Turkey and Syria sake of di earthquakes.

Poland Prime Minister Mateusz Morawiecki say im thoughts and prayers dey wit di families of di victims as e add say Turkey fit cound on Poland.

On im own part, di Director-General of di World Health Organisation (WHO) say dem don activate dia network of emergency medical teams to provide essential healthcare for di pipo wey injure and di pipo wey di earthquakes affect pass.

Images subject to copyright.