Sporting world dey pray for Ghanaian player Christian Atsu wey trap for Turkey earthquake

Wia dis foto come from, Christian Atsu/Twitter
Ghana president Nana Akufo-Addo join many Ghanaians all over de world to pray for di safety of Christian Atsu.
President Akufo-Addo for statement wey e release also commiserate wit di govments of Turjey and Syria for de disaster.
“On behalf of di govment and people of Ghana, I extend heartfelt condolences to de govments and peoples of Turkey and Syria on de devastation and de tragic loss of lives Monday’s earthquake cause. May their souls rest in perfect peace.
“Our hearts and prayers go out to de survivors, and we pray dat say make dem see our fellow Ghanaian, Christian Atsu.
Di Ghana Football Association also tell fans to "pray" for former Chelsea and Newcastle forward Christian Atsu – wey tori tok say dey trapped under rubble for di earthquakes in Turkey.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Search and rescue team say dem dey look for Ghanaian player, Christian Atsu who dem possibly dey trapped under rubble after earthquake hit Turkey.
De Ghanaian player according to reports for Turkey be unaccounted for, but dem dey try find de Astu de another staff member, Taner Savut.
De earthquake hit parts of Turkey around 4.00am on Monday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Before dis incident Christian Atsu score goal inside game wey en team, Hatayspor win.
He even tweet about de outcome of de game on twitter before de incident.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
De club neva talk anything about de disaster.
No be only Atsu dey trapped under de rubble, director Taner Savut also dey there.
Dem manage rescue some players wey dey inside de team building with Atsu.
Two players, Burak Öksüz den Bertuğ Yıldırım dey inside good condition after dem pul dem out of de building.
Dem find other staff, Ekşioğlu and Osman Ateş, who be members of de technical team dey in good condition.
Social media users for Ghana and around de world dey send in dia prayers to Christian Atsu who still be unaccounted for according to Turkish media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5
Christian Atsu profile
Christian Atsu be Ghanaian international player who dey play professional football in de Turkish Super League.
Born 10 January 1992, Ghanaian professional footballer dey currently play for Hatayspor.
He start en career for Porto, wey he later spend one season on loan for Rio Ave.
In 2013, Chelsea sign am for £3.5 million wey dem loan am to Vitesse Arnhem, Everton, AFC Bournemouth den Málaga.
After spending de 2016–17 season on loan for Newcastle United, he complete en permanent transfer to de club in May 2017.
As an international player he play over 30 caps since he join Black Stars in 2012.
Atsu represent Ghana for de 2014 FIFA World Cup and two Africa Cup of Nations tournaments.
He helped de team finish as runners-up for de 2015 Africa Cup of Nations where he win Player of the Tournament and Goal of de Tournament awards.