'Fear catch me as de earth start dey shake under my feet'

Wia dis foto come from, Getty Images
Parts of Ghana capital, Accra experience earth tremor today around 11.53am.
According to Android Earthquake Alert System wey capture de tremor, de earth quake be around magnitude 4.0.De epicenter of de earth tremor according to Android Earthquake Alert Systems dey western part of Accra, 10 km from Gbawe.
Residents around Kasoa, Gbawe, McCarthy Hill, Legon, Dansoman den oda parts of Accra feel de impact.
“I dey inside my room wey suddenly I realize say de earth start dey move under my feet, fear catch me” Susan Asare talk BBC Pidgin.
“De whole shake last some few seconds, both me and my mother feel am but e no keep wey we realize say what dey happen be earth tremor” she add.

Wia dis foto come from, Android Earthquake Alert System/Google
Social media react to de earth tremor
Some people talk BBC say dem no really notice anytin, but social media make full plus pipo who dey share tweets about de earth tremor.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Odas too no really sure if what dem feel be earth tremor as di tin confuse dem.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Timeline of earthquake/earth tremor for Ghana
- 1862 - Magnitude 6.5 earthquake hit de coastal parts of Ghana, spread to Togo and Benin. Dis earthquake kill three people.
- 1906 - Dis earth tremor hit parts of Volta Region but no record damages
- 1939 - Dis be de deadliest experience for Ghana as de magnitude 6.6 earthquake kill 17 people wey leave 133 injured.
- 1997 - Magnitude 3.8 hit de capital Accra in January. De dame year another one with magnitude 4.1 hit Accra in February. Finally, on 6th March, 1997 magnitude 4.8 earthquake hit Accra again.
- 2003 - In May 2003, Magnitude 3.8 earthquake hit Accra.
- 2006 - Magnitude 3.7 also hit Accra around January 2006.
- 2007 - In September 2007, magnitude 5.2 earthquake hit parts of Takoradi inside Western Region.
- 2018 - In December 2018, magnitude 2.6 earth tremor hit Accra.
- 2019 - Around January 2019, another magnitude 2.6 earthquake hit Accra
- 2020- In 2020, anoda earth tremor with magnitude 4.2 hit some areas for Accra.
- 2022 - In 2022, another magnitude 4.0 earth tremor hit de Western parts of Accra from de dame epicenter.
Geological Authorities for Ghana talk BBC Pidgin say de frequency of earth tremors dey show say earthquake fit happen for Ghana.
End of Di one wey oda users dey read well well













