India bridge collapse: Death toll rise to 141, many still dey miss

    • Author, Merlyn Thomas
    • Role, BBC News

At least 141 pipo don die afta one bridge collapse for India western state of Gujarat, officials say.

One local official say most of those wey don die na women, children or elderly. Dem just reopen di bridge for Morbi week ago after repairs.

Overcrowding dey ontop di bridge for di time as pipo bin dey celebrate di Diwali festival, officials tok

Dem build di 230-metre-long (754 feet) colonial-era bridge during British rule of India for di 19th Century.

Di death toll dey expected to rise further.

Police, military and disaster response teams don dey deployed and di rescue effort still dey on.

Dem don rescue more dan 177 pipo so far, officials tok.

"Many pikin bin dey enjoying holidays for Diwali and dem come here as tourists," one eyewitness call Sukram tell Reuters news agency.

"All of them fall one on top of another. Di bridge bin collapse due to overloading."

Videos on social media show how dozens of pipo dey clinge onto di wreckage as emergency teams dey try rescue dem. Some survivors dey clamber up di bridge broken netting, and others dey manage to swim to di river banks.

Reports say several hundred pipo bin dey ontop di bridge when e collapse at around 18:40 India time (13:10 GMT) on Sunday.

One video wey dem shoot before di collapse show how e dey packed with pipo and swaying and many gripping di netting on im sides.

Indian Prime Minister Narendra Modi, wey dey im home state of Gujarat on a three-day visit, say e dey "deeply saddened by di tragedy".

Mr Modi don announce compensation for di injured, as well as di next of kin of those wey don die.

Di authorities don promise full investigation. Dem dey ask questions about whether dem do safety checks before dem reopen di bridge. E be popular tourist attraction known locally as Julto Pul (swinging bridge).

Home Minister Harsh Sanghavi say dem don register number of criminal cases over di incident.

Prateek Vasava bin dey ontop di bridge when di incident happun. E tell 24 Hours Gujarati-language news channel how e take swim to di river bank.

Several pikin fell into the river, e say, adding: "I want pull some of dem along with me but dem drown or got swept away."

Videos show scenes of kasala as pipo wey dey look near di river dey attempt to rescue those wey trap inside di water as darkness dey come.