You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Thailand school attack: At least 37 pipo die inside day care centre shooting
At least 37 pipo don die and odas injure inside one gun and knife attack by one former police officer for one pre-school child daycare centre inside Thailand.
Police say e kill imself and im family afta one manhunt following di attack for Nong Bua Lamphu province.
Children and adults dey among di casualties for di nursery - police say di attacker shoot and stab im victims before going on di run.
Di motive no clear. Police say dem dismiss di officer last year.
Di victims of di attack dey reported to include children as young as two. At least 12 pipo also wound.
"Di shooter come in around lunch time and shoot four or five officials for di childcare centre first," one local official Jidapa Boonsom, wey dey work nearby, tell Reuters news agency.
"At first pipo bin tink say na fireworks," she tok, adding say di gunman den force im way enter di locked room wia di children bin dey sleep.
Thai Prime Minister Prayuth Chan-ocha describe di shooting as "a shocking event".
End of Di one wey oda users dey read well well
Police name di attacker as Panya Kamrab. E run comot di scene inside a white-four door Toyota pick-up truck with Bangkok registration plates.
One senior police officer for Nong Bua Lamphu province say 23 pikin dey among di casualties, AFP news agency report.
E say Kamrab, di police lieutenant colonel, na pesin wey dem dismiss last year for drug use.
Mass shootings for Thailand no common although gun ownership rates dey somehow high for di region. Illegal weapons dey also common for di south-east Asian kontri, according to Reuters news agency.
Di nursery attack dey come less dan a month afta one army officer shoot dead two of im colleagues for one base for Bangkok.
For 2020, one soja kill 29 pipo and injure dozens more for di city of Nakhon Ratchasima.